Blog no sidebar

Background

obodo oyinbo

Iran Warn Trump Say Dem No Go Reach Agreement If Threat Continue

By : Jolayemi Olajide Iran Foreign Minister Abbas Araghchi don warn Donald Trump say if dem continue dia threat, dem go stop peace talks. Im tuk dis one give tori pipo on Monday, after report say, Trump America  dey plan force di peace  agreement with Iran. Iran dey insist say, nor be everything dem go use force, but if US insit dem go give dem hot, hot.

todayJuly 7, 2026 10

OBODO NAIJA

FG Wan Bring back more Nigerians Back from South Africa Over Xenophobic Attack 

By : Jolayemi Olajide Nigeria Government say e go sti bring Nigerians back from South Africa on Tuesday because of fresh attacks on foreigners. Foreign Affairs Minister Bianca Odumegwu-Ojukwu tell news tatafos on Tuesday, say another flight go leave dis week. Three groups of Nigerians don already return since the evacuation start last month. She also advise Nigerians wey still dey South Africa make dem think well whether to stay […]

todayJuly 7, 2026 11

Lagos

Lagos Police Burst one jaguda boys Ama, gbab 150 Suspects

By : Jolayemi Olajide Lagos State Police  command ehn, don do dia normal James Born doings  gbab 150 suspected  jaguda boys, say dem lap di  ama wey dey inside dumpsite for Boolar area near Okofilling Bus Stop, Igando. Na police oga Tijani Fatai naim use im yamchop mouth konfamate this mata for police headquarters  for im monthly tuk, tuk doings. Di senior man Police oga ehn,  konfam oh, say during […]

todayJuly 7, 2026 12

Lagos

Sanwo-Olu, Umahi do monitoring Spirit for Lagos-Calabar Coastal Road, explain di flood mata

By : Jolayemi Olajide Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, and wi Minister of Works, David Umahi, do small ibeji movings porporly  all di social media post about  Lagos-Calabar Coastal Road, say nor be di road di cause flood anything. Di Two both of dem  tuk dis one when Umahi and some members of the National Assembly visit di govo. Sanwo-Olu welcome oga  minister and di lawmakers, and praise di Federal […]

todayJuly 7, 2026 13

Sports

Ronaldo World Cup Dream Ends

By: Yusuf Abuh Cristiano Ronaldo World Cup journey don end for heartbreak again, after Spain beat Portugal 1-0 for Dallas Stadium on Monday night, thanks to Mikel Merino late goal. Ronaldo, wey plenty people believe say na im last World Cup match be dis, try lead Portugal attack with João Félix and Bruno Fernandes but dem no fit score goal. Spain defence stand gidigba throughout di match, while goalkeeper Unai […]

todayJuly 7, 2026 17 1

obodo oyinbo

UN, Partners Rush Help For Venezuela Earthquake Victims

By: Yusuf Abuh United Nations and im joinbodi partners don decide say dem go increase dia help for for Venezuela after two wicked ejima  earthquakes touch di country wetin nor good. UN tuk, tuk person, Stéphane Dujarric tok dis one for news conference for New York on Monday, say dem go continue to support everybody wey di disaster touch. U sabi say, di two earthquakes wey measure 7.2 and 7.5 […]

todayJuly 7, 2026 9

OBODO NAIJA

Information Minister, Idris Position North News Tatafos For Beta Tomorrow

Wi Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, don clear, clear Nigerian tatafos for North,  not to burn di country with bad news report. Im tuk dis on for di first Arewa Media Summit wey shelle for Kano on Monday. Di Minister explain say di future of di region no depend only on better roads or farming, and dat tori dem wey dis tatafos dey put out sti, fit […]

todayJuly 7, 2026 9

OBODO NAIJA

Tinubu Send FCCPC To Checkmate Big Tech

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido, Bola Tinubu don order wi Federal Competition and Consumer Protection Commission (FCCPC) dat make dem touchlight all di big technology companies and AI to ensure say dem nor spoil business for Nigerians. Di order dey come after the Nigerian Press Organisation (NPO), number one joinbodi tatafos, wire message to wi baba seyi say tech companies wan comot food for dia table. According to statement […]

todayJuly 7, 2026 10

Lagos

Lagos Christians Match for Peace, Demand End to Insecurity

Chairmo of Christian Association of Nigeria (CAN) for Lagos State, Bishop Stephen Adegbite, nor be small tin im do for Lagos oh, carry bible and cardbroad dey protest say Naija security don dabaru. Dem carry placards with messages like "Pray for Nigeria," "No to School Children kidnap," and "Release the Oyo School Children Now!" And dis ogbonge wi nor go gree movement start, and end for, Alausa, as clergymen, Christians […]

todayJuly 7, 2026 7

Lagos

LAWMA Say Stop To Dey Dirty Di Road Or Face Di Gbege

By: Yusuf Abuh LAWMA don warn residents to stop dumping waste for gutter and road sides because e dey cause heavy flood and sickness. Households must pack dia refuse inside approved dustbins for PSP operators to come pick dem up. Dem encourage residents to separate plastic and metal for recycling to help keep Lagos clean. LAWMA promise to enforce rules so everybody go enjoy healthy environment.

todayJuly 6, 2026 12 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds