Blog no sidebar

Background

south west

Ondo Police kpai 2 Jaguda kidnapers

Ondo State police command don do small kpachiaon rascal some jaguda boys kpai  two suspected kidnappers for  Akure–Owo Expressway, Akure North Local Government Area of di state Command tuk tuk person, DSP Abayomi Jimoh, naim konfamate dis mata for statement on Wednesday give tori pipo, say na major breakthrough against jaguda boys. Di senior man police tuk tuk explain sya na based on betalicious inteliigent informate dem take operate on […]

todayJuly 8, 2026 10 2

Sports

Messi Score As Argentina Survive Egypt Scare

By: Yusuf Abuh Argentina fight back from two goals down to beat Egypt 3-2 for Atlanta and qualify for di World Cup quarter-final. Yasser Ibrahim and Mostafa Ziko bin give Egypt 2-0 lead, even as Lionel Messi miss penalty after goalkeeper save am, before Cristian Romero start di comeback with header. Messi later score di equaliser to make am nine straight games wey im don score for World Cup matches […]

todayJuly 8, 2026 14 1

obodo oyinbo

US Forces Launch Heavy Strike Inside Iran

By: Yusuf Abuh US military don launch heavy air strikes inside Iran on Tuesday after Iran forces attack three merchant ships for inside di Strait of Hormuz. US Central Command tuk for X (Twitter) konfam say hand really touch Iran oh, nor be small. Di US military dey vex say wetin Iran do pass line, e dey dangerous, and e break di ceasefire agreement wey start since April 8. Dis […]

todayJuly 8, 2026 11

OBODO NAIJA

President Tinubu Pick Squad To Create Laws For State Police  

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido, Bola Tinubu on Tuesday don launch ogbonge special quad  wey dem dey call Presidential Working Group on di National Policing Bill, to map di way for Naija state police Na Chief of Staff, Femi Gbajabiamila, stand in for di Presido to open di committee group for inside di Presidential Villa for Abuja. Dis move dey happen after di National Assembly pass di new law […]

todayJuly 8, 2026 11

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Give ICPC 30 Days To Investigate Fake PFIPC

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido Bola Tinubu don order Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission, wey dem dey call ICPC, say make dem touch light every as e take concern  Presidential Foreign Intervention Promotion Council (PFIPC) and di ogbonge agency wey don dey cause jogolo for weeks now. Presido say make ICPC finish di investigation and submit full report give am within 30 days. According to Special […]

todayJuly 8, 2026 13 1

Lagos

Federal Gornment To Scatta Tins To Build Gutters For Lagos Coastal Highway

By: Yusuf Abuh Wi Minister of Works, Dave Umahi, don spill out new plans to stop Lagos flooding for di Lagos-Calabar Coastal Highway, say dem one build new gutters. Umahi tuk dis one meeting with stakeholders for Lagos say,  dem joinbodi with di lagos gornment build service lanes. He explain say dis new plan na long-term arrangement to put end to di flood problem wey heavy rainfall dey always cause […]

todayJuly 8, 2026 11 1

Articles

KONFAM FM DO JOINBODY COLLABO WITH MINISTRY OF HOUSING

One ogbonge proverb yarn say, House wey dem no finish, fit become hideout for wahala or Jaguda boys" and na di same message Lagos State Ministry of Housing carry come today as Konfam FM 89.5 pay dem courtesy visit for Alausa, Ikeja. For di meeting, di permanent secetary of di ministry Engr. Abdulhafis Gbolahan Toriola call on Konfam FM make e join hand with government to educate Lagos residents on […]

todayJuly 7, 2026 17

Local

Delta Commissioner of Police Punish Two Police Officers

By: Yusuf Abuh Two police officers don chop beta koboko for Delta State, don lose dia rank after dem find dem guilty of extortion and other misconduct ontop one viral video. For di viral video di police dey collect kpaje with POS from motorist through POS Delta Police tuk, tuk, SP Bright Edafe, konfam dis development say Commissioner of Police, CP Yemi Oyeniyi, approve di punishment after orderly room trial. […]

todayJuly 7, 2026 10

Sport Yarns

CAF Confirm Rangers, Rivers United for Champions League Qualifier

By : Jolayemi Olajide Confederation of African Football (CAF) don confirm say Enugu Rangers and Rivers United go represent Nigeria for di qualifying rounds of di 2026/27 CAF Champions League. According to di list wey CAF release on Monday, 24 clubs from 12 African countries go compete, with each country providing two teams. Defending champions Mamelodi Sundowns of South Africa, Zamalek, Pyramids, TP Mazembe, Orlando Pirates, Esperance and oda top […]

todayJuly 7, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds