Blog no sidebar

Background

OBODO NAIJA

Reps Approve Customs N11.07trn Revenue Target for 2026

By: Yusuf Abuh Di House of Representatives Committee on Customs don carry hand up approve di2026 budget for Nigeria Customs Service, with target to make 11.07 trillion naira revenue. Customs Boss, Adewale Adeniyi, tell di lawmakers say di target make brain because dem beat dia 2025 target when dem clear 7.25 trillion naira. For di new budget, Customs allocate big money for capital projects, staff overhead, and dem even plan […]

todayJuly 6, 2026 10

Local

Oyo Govt: We Dey Work To Save Oriire Kidnap Victims

By: Yusuf Abuh Oyo State Government don promise say security pipo dey work well-well to save di school children and teachers wey bandits kidnap for inside Oriire Local Government since May 15. Di government tell di families say dem feel dia pain, and dem dey stand with dem as operation dey go on to bring di victims back safely. Reports show say di bad pipo carry dem go inside Old […]

todayJuly 6, 2026 20

Sports

UEFA Drag FIFA Say Why Dem Do U-turn For Balogun Ban

By: Yusuf Abuh UEFA don accuse FIFA, wahyooo don dey inside di world cup oh say why dem go suspend Folarin Balogun one-match ban for one year. Dat one mean say, Balogun go play for USA World Cup Round of 16 match against Belgium. FIFA take di decision after US President Donald Trump intervene for di matter, and di move don spark plenty argument. UEFA  say FIFA cross di red […]

todayJuly 6, 2026 10 3

obodo oyinbo

Fresh Russian Strike Hit Ukraine Before NATO Meeting

By: Yusuf Abuh Nor be small tin Russia dey do oh, dem blast Ukraine again, kpaing at least 18 pipo for Kyiv, Ukraine, for di second time within one week. Dis attack sef hapun, just before di important NATO meeting, and like dis, Ukraine presido Volodymyr Zelensky dey beg  frens and family to con help defend Ukraine. To tell u how di mata serious reach, European Union sef don konfam […]

todayJuly 6, 2026 8

OBODO NAIJA

IPMAN Promise Cheaper Fuel For Nigerians

By: Yusuf Abuh Senior man presido of petro sellers for di obodo Nigeria,  (IPMAN), Elijah Shettima, don drop micro soft word say  Nigerians nor need to worry body too much, dat petrol price go soon come down. Shettima tok dis one for interview wey e get with news tatafos for Abuja on Monday. E say IPMAN main plan na to make independent marketers fit buy petrol directly from Dangote Refinery. […]

todayJuly 6, 2026 12

Local

Police Burst Thief Hideout For Ado Ekiti, Arrest Four Suspects

By: Yusuf Abuh Ekiti State Police Command do small kpichao arrest four suspect, say dem bin wan go move tins from shops inside  Omisanjana area of Ado Ekiti. Police tok say dem raid one criminal hideout on Sunday and gbab one, Abdurazak Suleiman, John Okori, Francis Okori and Kehinde Alabi. As police look di holes dem, dem see plenty items, property wey di guys dem thief, including perfumes, bathing soaps, […]

todayJuly 6, 2026 7

Local

10 Pipo Kpai For Lagos-Ibadan Expressway Askident

By: Yusuf Abuh Nor be small jogolo for Lagos, Ibadan expressway, say one Sunday early mormor askident don kpai 10 pipo, including one pikin, and six others collobi wunjury after one Toyota motor go jamisoke Dangote truck for Sapade Bridge. According to Naija road motoring spirit, FRSC, di truk bin dey reverse for di highway when di Toyoto motor vanvanvan gboai jam di truck. Di tuk, tuk of di for […]

todayJuly 6, 2026 6

obodo oyinbo

China Missile Test Shake Pacific, Australia

By: Yusuf Abuh Japan, New Zealand like dis now dey call world pipo make dem hold china oh, dat china dey test bomb for Pacific Ocean. Chinese gornment talk say di test na part of dia yearly military training and e no target any country. Japan, Australia and New Zealand don raise concern, which one be, e nor target anybody, na play, play dey turn to hit and go, dat […]

todayJuly 6, 2026 13

OBODO NAIJA

President Tinubu Beg Rotary Make Dem Join Hands Build Nigeria

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido, Bola Tinubu don wire call to naija obodo oyinbo business partners (Rotary International) say make dem flog business come, whether, healthcare, education, youth empowerment and community development across, say Nigeria go do thank you sir. Oga presido, tuk dis tuk through im Seco to di gorment of federation, George Akume wia dem go sing congratulation song for Olayinka Babalola for becoming di second African […]

todayJuly 6, 2026 6

Entertainment

Sam Larry Land for Hospital, But Him Bouncer Kpai

Popular Nigerian music promoter and socialite, Sam Larry, don land for hospital after one serious motor askident wey happen for Lagos-Calabar Coastal Road. According to reports, di askident happen on early Saturday morning as di motor wey carry Sam Larry jam one trailer and di motor scatter well well. Reports also talk say Sam Larry  bouncer no survive di askident, as e kpai for di scene before help fit reach […]

todayJuly 6, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds