Blog sidebar

Background

National

FG To Ban Unrated Textbooks For Schools From September 2026

By: Esther Ayoola Federal Government of Naija don announce say dem go introduce National Textbook Ranking System for primary, junior and senior secondary schools to improve education standard for Naija. Director of Press for Ministry of Education, Folasade Boriowo, naim dey tuk dis one for statement on Sunday, say, di plan na to stop bad textbooks from entering classrooms. She explain say Nigerian Educational Research and Development Council go dey […]

todayApril 27, 2026 21

National

Kano Gorment Advice Dia Youths Over Shameful Behaviour Before First Lady

By: Esther Ayoola Kano State Govo, Abba Yusuf don condemn di action of some youths wey reportedly show dirty character of giving underwear to women, during an official visit of Oluremi Tinubu for Kano State Naija. For statement wey Govo Chief Press Secretary, Mustapha Muhammad release on Sunday, Yusuf tuk say di behaviour nor represent Kano culture at all. E yarn dis one during Third Special Prayer for lasting peace […]

todayApril 27, 2026 27

Lagos

How Lagos Gorment Enter 60MW Power Deal With 3 Electricity Company

By: Esther Ayoola Lagos State gorment, don do small megege movement sign Power Purchase Agreements with three companies, Fenchurch Power, Mainland Power and Viathan Group to generate about 60MW electricity for di state. Senior man govo, Babajide Sanwo-Olu naim lead di way, put dis one for statement on Sunday, say di agreement as part actions to improve power supply under Lagos Electricity Law 2024 and Nigerian Electricity Act. Di signing […]

todayApril 27, 2026 21

obodo oyinbo

Suspected Shooter For Trump Dinner Arrange Bodi For Court Today

By: Esther Ayoola Di ogbonge senior gunman wey dem accuse say go scatta U.S Presido Donald Trump gala dinner for Washington D.C. USA on Saturday night, say like dis now go make first appearance for court today. According to U.S officials, say di suspect allegedly bin wan kpai Trump and other top officials during di press dinner before. Trump himself post video and pictures of how security agents rush am […]

todayApril 27, 2026 20

National

Army Explain How NYSC Member Take Kpai Robbery Operation for Abuja

By: Esther Ayoola Nigerian Army, through im Acting Assistant Director, Army Public Relations for Guards Brigade, Lt. Olawuyi Odunola, don konfamate say NYSC member Abdulsamad Jamiu sadly kpai during security operation against armed robbery for Abuja. Di incident hapun for early hours of April 25, 2026 for Shagari Estate, Dei-Dei inside Federal Capital Territory. According to wetin Army tuk, Guards Brigade Quick Response Group wey dey do routine night patrol […]

todayApril 27, 2026 30

National

FG Start Move To Calm Aviation Wahala As Fuel Price Scata Airline Operations

By: Esther Ayoola Minister of Finance, Taiwo Oyedele, and Aviation Minister, Festus Keyamo, don finally meet demsevles for Abuja to tuk how dem go take solve di rising cost of aviation fuel wey dey affect airline operations. According to Oyedele,  say dem get constructive discussion on how di sharp increase in Jet A1 fuel dey push airlines under pressure and dey cause higher ticket prices. Say dis meeting  na to […]

todayApril 27, 2026 18

Education

Viral 394 UTME Result Na Fake – JAMB

Di Joint Admissions and Matriculation Board don come out reject one UTME result wey dey trend for social media, say na fake oh. Dem say di result show one girl from Cross River, Okon Winniefred Sampson, scoring 394 out of 400, Jamb now dey tuk say dat kind result nor dey dia system. According to JAMB spokesman, Fabian Benjamin, di result slip na fake result. Fabian still beg Nigerians make […]

todayApril 27, 2026 29

Politics

Opposition Parties Reject Ibadan Summit

Branches inside Peoples Democratic Party, African Democratic Congress, Accord Party and Labour Party don reject di Ibadan opposition summit, say e dey one sided. Dem tuk say dem go still bring separate candidates to challenge Bola Tinubu for 2027 election. PDP National Working Committee, with support from Nyesom Wike, accuse dia members say dem be  “imposters” wey dey deceive leaders like Atiku Abubakar and Peter Obi. Meanwhile, ADC groups, Accord […]

todayApril 27, 2026 24

obodo oyinbo

King Charles State Visit To U.S To Go Ahead As Plan Afta Washington Shooting Incident

By: Esther Ayoola Britain King, Charles III state visit to U.S, like dis, go sti go as planned, even when jaguda boys Shoot U.S presido Donald Trump Ear miss. Dis konfamation sef dey come from  Buckingham Palace  on Sunday. Di incident hapun for White House Correspondents’ Association dinner on Saturday night, just less than 48 hours before King Charles and Queen Camilla go begin dia four-day visit. Palace tuk say […]

todayApril 27, 2026 28

obodo oyinbo

Mali Defence Minister kpai For Bomb Attack As Rebel War Scatter Kati, Kidal

By: Esther Ayoola Mali defence minister Sadio Camara don Kpai  like dis, Say jaguda boys  bomb car near im house for Kati near Bamako. Dis sef na di family of di late defence minister naim dey konfamate dis mata, say, even im wife and two grandchildren kpai in di process. Di attack happen as army dey fight serious battles against jihadist fighters and Tuareg separatist rebels for different cities like […]

todayApril 27, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds