OBODO NAIJA

770 Results / Page 9 of 86

Background

OBODO NAIJA

Esan West Boss Tell Drivers Wear APC Cap Or Face Palava

By: Mariam Ajayi Chairman of Esan West Local Government for Edo State, Blessing Ebhodaghe, don order commercial drivers make dem wear APC-branded cap or face sanction. Ebhodaghe give di warning when e visit motor park, say di order na to support Governor Monday Okpebholo plan to help Presido Bola Tinubu secure 2.5 million votes for 2027 election. E warn drivers make dem nor wear another political party cap, say anybody […]

todaySeptember 18, 2026 12

OBODO NAIJA

NSCDC Order Probe Into Kpai Of Illegal Miners For Niger

By: Kofoworola Olayinka Naija Security and Civil Defence Corps don order investigation into di kpai of some people wey dem arrest for illegal mining operation for Niger State on September 15 and 16. NSCDC spokesman, ACC Babawale Afolabi, say dem arrest di people for M.I. Wushishi/Lukoto axis. Commandant General, Prof Ahmed Abubakar Audi, don set up special team to find out wetin really cause di kpai, including how dem dey […]

todaySeptember 18, 2026 6

OBODO NAIJA

Tinubu Fit Settle Wike, APC Gov Palava For France

By: Mariam Ajayi Presido Bola Tinubu fit intervene for di growing wahala between some All Progressives Congress governors and FCT Minister Nyesom Wike ahead of di 2027 elections. One senior presidential aide talk say Tinubu dey expected to bring di two sides together to settle dia differences. Di aide say di meeting fit happen for abroad before di end of di week, as Tinubu dey currently on vacation for France. […]

todaySeptember 18, 2026 8

OBODO NAIJA

Sowore Vow Commot First Lady For Office If E Win 2027 Election

By: Mariam Ajayi African Action Congress presidential candidate Omoyele Sowore don drop am say if hin win di  2027 presidential election, say hin go cancel di office of di first lady, dis one nor be sherekanbia. Sowore drop dis hot statement TV sit down tok  on Thursday, say im nor dey for dat one wey im wife go con sit dwon for front of motor, begin do like small nokia […]

todaySeptember 18, 2026 11

OBODO NAIJA

Tinubu Mourn Olu Jacobs As Di Veteran Actor Kpai At 84

By: Ayobami Dada Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don mourn veteran Nollywood actor, Olu Jacobs, wey kpai at di age of 84. For statement wey im Special Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga, release on Wednesday, Tinubu tok say Olu Jacobs na one of Nigeria big-time actors, wey im career cover theatre, TV and movies for inside wi Obodo Nigeria and wi Obodo World. Tinubu say di late […]

todaySeptember 17, 2026 11

OBODO NAIJA

Federal Gorment Hellep Workers As Petrol Price Dey Rise – NLC

Nigeria Labour Congress (NLC), don call on Federal Gornment to quickly bring measures wey go reduce di suffering wey rising petrol price dey cause. NLC Presido, Joe Ajaero, tok for statement on Wednesday say petrol don reach about ₦1,430 per litre for major cities, while di price fit dey higher for places wey hard to reach. Labour warn say di petrol price increase go make economic hardship worse, as transport […]

todaySeptember 17, 2026 8

OBODO NAIJA

Only Six Northern Gofnors Support Tinubu For 2023 – Shettima

Vice Presido, Kashim Shettima don reveal on Wednesday say na only six out of 19 northern Gofnors support President Bola Tinubu presidential ambition for di 2023 election. Shettima talk dis one for di palace of Emir of Ilorin, Alhaji Ibrahim Sulu-Gambari, during di turbaning of Kwara Gofnor, AbdulRahman AbdulRazaq, as Sardauna of Ilorin Emirate. E say di tension wey follow di 2023 presidential campaign and election dey very clear, and […]

todaySeptember 17, 2026 15

OBODO NAIJA

Wike Tok Say Kwara Gofnor Dey Blame Am For Everything

By: Mariam Ajayi FCT Minister, Nyesom Wike, don tok say Kwara State Gofnor, Abdulrahman Abdulrazaq, dey always blame am for anything wey happen for im office or house. Wike talk dis one for interview with tori pipo on Tuesday, say anytime di Gofnor see snake or any kind reptile, e go say, “Na Wike.” Di FCT Minister also accuse Abdulrazaq say e dey focus more on gossip instead of doing […]

todaySeptember 16, 2026 14

OBODO NAIJA

ADC Drag Tinubu As Petrol Hit N1,470 Per Litre for Filling Station

By: Mariam Ajayi African Democratic Congress don tell Tinubu goment say na people wey no get mind dey dia, as petrol price don fly reach N1,470 per litre. ADC mouth-piece Bolaji Abdullahi naim dey  raise di alarm for Abuja. According to abdullahi, make APC confess oh, di plan wey dem get for Nigerians, say poor pipo dey cry wetin nor gud for di obodo naija, and nobody dey shake bodi. […]

todaySeptember 16, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds