OBODO NAIJA

770 Results / Page 56 of 86

Background

OBODO NAIJA

President Tinubu Send Letter Give Senate for  Marwa  to Join NDDC Board

By : Jolayemi Olajide Wi oga Presido, Bola Tinubu don write  Senate say  make dem look into into di appointment of Dr Zainab Marwa as member of the Niger Delta Development Commission (NDDC) governing board. Baba Seyi put dis one for request letter give  Senate Presido, Godswill Akpabio,  am im read am out  for dia  meeting on Thursday. Inside di letter, Tinubu  say Dr Zainab Marwa go  represent the North-East […]

todayJune 4, 2026 18

OBODO NAIJA

Senate Nack Federal Gornment  Akpako for Head  Say Make Dem Sharply Rescue Oyo kidnap victims

  Nna wa o, for inside Abuja, the Senate don nack Federal Gornment and security people strong Akpako for head say  make dem sharply rescue the Oyo State school students and teachers Wey bad boys kidnap. Na Senator Abdulfatai Buhari carry the mata  tuk first  say around 46 people dey inside the kidnappers net. While  Senator Adams Oshiomhole tuk about o how the military dey spend  money Wey dem dey […]

todayJune 3, 2026 16

OBODO NAIJA

Court sentence four Owo church attackers to death, release one person 

By : Jolayemi Olajide Federal High Court for Abuja don sentence four guys to death by hanging because of the deadly attack wey dem do for Saint Francis Catholic Church for Owo, Ondo State. Justice Emeka Nwite convict di four bad boys on Wednesday after the judge see say di evidence wey DSS bring clear wetin nor good, say dem be part of di  terrorist group wey commit the crime. […]

todayJune 3, 2026 19

OBODO NAIJA

Wike Tell Police Say Make Dem Arrest Pipo

By : Jolayemi Olajide FCT Minister Nyesom Wike don order security agencies on Wednesday, June 3, make dem arrest any person wey dey drop former President Goodluck Jonathan picture everywhere for Abuja to cause political katakata. Wike yarn say e pure wrong make anyone dey parade Jonathan as presidential candidate when di man himself never use e own mouth talk am. Di minister clear air say candidate na person wey […]

todayJune 3, 2026 441

OBODO NAIJA

How N100k Minimum Wage Fit Kill Small Business

By : Jolayemi Olajide Private sector pipo don raise alarm say make nobody force dem to pay N100,000 minimum wage like some states dey do. Business groups yarn say na only few big companies fit afford am, while small and medium shops dey suffer inflation, fuel wahala, light bill and customer scarcity. Di warning land as talk dey fly about new general minimum wage, with some governors already lifting workers […]

todayJune 3, 2026 18

OBODO NAIJA

Datti Baba-Ahmed Leave Labour Party Finally For PRP

By : Jolayemi Olajide Yusuf Datti Baba-Ahmed don waka comot from Labour Party enter Peoples Redemption Party (PRP). Im tuk dis one for one podcast on Wednesday, say Peter Obi suppose first settle Labour Party gbege before e im piante comot di party. Datti clear mata say e no be Obi shadow, na im own mind dey guide am. Normal say goat dey follow farmer, nor mean say goat go […]

todayJune 3, 2026 23

OBODO NAIJA

INEC  Begin  touchlight  Voter Database  say Mata Leak

By : Jolayemi Olajide Di Independent National Electoral Commission (INEC) on Tuesday say e don start full blood check  into allega of some jaguda boys access dia  Continuous Voter Registration (CVR) database. Dis na after information about one candidate for a political party primary election in the Federal Capital Territory (FCT) leak enter public space. INEC National Commissioner and Chairmo of Information and Voter Education Committee, Mohammed Haruna, put for […]

todayJune 2, 2026 15

OBODO NAIJA

Teachers For Lagos Storm Street, Demand Freedom For Kidnapped Teachers And Students

By : Jolayemi Olajide Teachers for Lagos State sef don join di nationwide protest, for dis Oyo school children kidnap. Dem carry di wahala  go Lagos State House of Assembly for Alausa, demanding, say gorment gat raise body for di mata, everyday kidnapping kidnapping say dem don tire. Di protesting teachers, under di Nigeria Union of Teachers, trek from Ikeja Under Bridge,  raise dia  voice  dey shout abeg oh rescue […]

todayJune 2, 2026 23

OBODO NAIJA

Oyo Parents Reject Gornment Rice And Cash Dey Cry For Dia Pikins

By : Jolayemi Olajide Meanwhile, Angry families of dipupils and teachers wey bandits kidnap for Orire local government area for Oyo State don reject rice and money wey oyo state gorment bin give dem to cool dia temper. Di Baale of Yawota, Emmanuel Alade, clear news tatafo on Monday, how dem feel, say di parents pursue baba govo, Seyi Makinde team comot because food no be dia problem now. Di […]

todayJune 2, 2026 28

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds