OBODO NAIJA

770 Results / Page 73 of 86

Background

OBODO NAIJA

Ondo Monarchs Beg Tinubu to Share Pipeline Surveillance Power for Ilaje 

Monarchs from Ilaje Local Government Area for Ondo State don wire  appeal  letter wi oga  Presido,  Bola Tinubu make dem dis pipeline surveillance work touch everywia. Di traditional rulers under Ilaje Council of Obas tuk dis one inside letter wey dem send to President and sign by Secretary, Oba Obafemi Ogbaro, after dem meet for Igbokoda headquarters on Friday. Dem explain say di current central system dey limit community involvement […]

todayApril 17, 2026 28

National

President Tinubu Sign ₦68.32trn 2026 Budget con Still Extend 2025 Budget Time

President Bola Tinubu  don sign the 2026 Appropriation Bill into law, wey approve ₦68.32 trillion spending for Nigeria 2026 fiscal year. Di presidency announce dis ogbonge update on Friday for official statement wey Special Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga sign, say dem also extend 2025 budget implementation from March 31 go June 30, 2026. Di budget include ₦4.799 trillion for statutory transfers, ₦15.8 trillion for debt service, ₦15.4 […]

todayApril 17, 2026 29

National

FG Call for Emergency Meeting with Airline Pipo Say Aviation Fuel Rise

Di Federal Gornment don beg local airline operators make dem nor stop flight operations because of di sharp increase for Jet A1 fuel price. Minister of Aviation, Festus Keyamo, make dis appeal for one letter wey im send give Airline Operators of Nigeria on Thursday. For di letter, Im also beg dem make dem think again before dem increase flight ticket price for passengers. Dis mata come as many airlines […]

todayApril 17, 2026 30

National

INEC Chairmo to Lead Big Tuk on Nigeria Election Mata for April 29

Chairmo of Independent National Electoral Commission, INEC, Prof Joash Amupitan,  say like dis  dey prepare body to deliver  keynote speech for one big stakeholders meeting wey go talk about Nigeria election process. Di programme dem title am, Law Corridor, one Abuja law firm, naim dey organise am and dat e go shelle  April 29, 2026 for Abuja. According to report,  say big men and women from political parties, civil society […]

todayApril 17, 2026 22

OBODO NAIJA

Former Ondo State Govo, Mimiko Resign Officially from PDP

Former Ondo State Govo, Dr Olusegun Mimiko, don resign from Peoples Democratic Party (PDP) on April 10, 2026. E make di announcement through letter wey he write give PDP Ward 7 chairman for Ondo West Local Government Area, Ondo State, so na through official letter he take do am. Di Former govo tuk im reason, say di reason na to clear all speculations and questions wey people dey ask about […]

todayApril 17, 2026 29

National

President Tinubu Tuk Why Im Nor dey Fear for Di 2027 Election

Wi oga Presido, Bola Tinubu don scata mouth again oh,  say e no dey fear any opposition, as e describe dem as pipo wey just dey make noise and wey nor understand law. E yarn dis one during meeting with Renewed Hope Ambassadors leaders from all 36 states for State House, Abuja on Thursday. Say Na oga of APC govos group, , Hope Uzodimma, wey be DG of the ambassadors, […]

todayApril 17, 2026 27

National

APC Chairmo, Yilwatda Press Tuk on Party Structure

APC National Chairmo, Nentawe Yilwatda, don clear mata say  nothing spoil  if more politicians  join di  APC  from opposition side. Im yarn dis one For one media chat wey happen for Abuja, Yilwatda say APC get solid system to manage different interests as membership dey grow. E still add say the party don already prove say dem sabi handle problems, so size nor mata at all.

todayApril 17, 2026 31

OBODO NAIJA

Nigerian Army Bury Fallen General, Soldiers For Borno

For Nigerian Army side, dem don bury Brigadier General Oseni Braimah, Captain Ismail and oda soldiers wey die for recent attack for Borno State. Dem do di burial for Maimalari Cantonment Cemetery for Maiduguri with full military honour. Na on April 9, fighters wey dem suspect say na Boko Haram and Islamic State West Africa Province attack soldiers for Benisheikh along Maiduguri-Damaturu road, kill di officers and men. Big people […]

todayApril 16, 2026 50

OBODO NAIJA

Police Gbab One Man Wey Cut Small Pikin Head For Oyo

Oyo State Police Command don gbab one 23-year-old guy wey dem catch with pikin head for Ibadan. Police tuk tuk , Ayanlade Olayinka, yarn on Sunday say di matter happen on Saturday, April 11, for Adigun Village, Olorunda Ogunsola area inside Ona-Ara Local Government Area. According to am, police move sharp-sharp after dem receive informate say some pipo kpai one small girl con cut her head. Olayinka talk say dem […]

todayApril 12, 2026 37

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds