obodo oyinbo

60 Results / Page 4 of 7

Background

obodo oyinbo

US Wan Enter Colombia, Trump Say Colombia Presido Get Bad Character

By: Esther Ayoola US Presido, Donald Trump like dis don turn attention to Colombia, say im no like Colombia Presido, Gustavo Petro. Dis one dey come afta world leaders send complain give am on why, U.S kramp Venezuela President Nicolas Maduro. For inside post for X, Trump tuk say goment for Colombia and Venezuela dey “sick,” and Petro dey do like person wey dey sell cocaine. Im still add am […]

todayJanuary 5, 2026 4 6

obodo oyinbo

Yemen Wahala, Say Saudi-Pipo An Separatists Scarra Yemen Border With Fight

By: Rilwan Agbomeji Fighting don break for Yemen, for Hadramout province wey dey near Saudi Arabia, between forces wey follow Saudi-backed govo and di Southern Transitional Council (STC) separatists. STC talk say Saudi Arabia dey bomb dia pipo near di border, but oga govo,  Salem al-Khanbashi yarn say dem just wan take back military bases “peacefully and systematically.” STC tuk, tuk, Lieutenant-Colonel Mohamed al-Naqib yarn say dia dey fight serious […]

todayJanuary 2, 2026 7

obodo oyinbo

Trump Say US Go Kwak Iran If Dem Kill Peaceful Protesters

By: Rilwan Agbomeji Unto mata for Iran, say US presido Donald Trump say America ready oh,  to robo cup for Iran gorment , if dem try kill protesters, say cost-of-living dey kill di living for Iran, as mehn dey protest am. Clash happen for different Iranian cities, and report tuk say six people don die since di protest increase. For Tehran, shop owners close dia  shops to protest high prices […]

todayJanuary 2, 2026 10

International

Israeli Soldiers Kill Pikin For Gaza Even After Ceasefire

By Ebi Oboko For Gaza, Israeli soldiers don kill one pikin wey dem dey call Youssef Ahmed al-Shandaghli for north side Jabalia an-Nazla. According to report, mehn, wimehn and childresis for Gaza dey suffer seriously because Israel nor gree make pipo con help dem for the gaza. Even with one ceasefire wey US help arrange for October, Israel still dey attack Gaza wetin nor gud, don kill over 400 Palestinians. […]

todayJanuary 2, 2026 7

obodo oyinbo

Russia Accuse Kyiv Say Dem Do New Year Drone Attack For Moscow

By Ebi Oboko Russia don go put  accuse for  Kyiv head say dem  jet li drone attack wey kill at least 20 people for hotel for Moscow-controlled part of Kherson, Ukraine, for new year day. Vladimir Saldo, wey be Russia-appointed governor for Kherson, talk say three drones hit cafe and hotel wey people dey celebrate New Year. Russia Investigative Committee don open probe into di attack, wey still wunjor plenty […]

todayJanuary 1, 2026 6

obodo oyinbo

Gaza Enter 2026 With Wahala Say Isreal Block Dia Helpers

By Ebi Oboko Israel don start bad character wey dem learn yesterday block 37 international aid groups, including Doctors Without Borders, wey dey help people for Gaza. Di government revoke their licences and accuse dem of wahala wey dem never prove. People for Gaza enter 2026 with worry and despair as humanitarian situation continue to dey worwor.

todayJanuary 1, 2026 11 6

obodo oyinbo

World Celebrate New Year 2026

By Ebi Oboko People all over di world don dey  celebrate new year. 2026, counting things wey sup for 2025,  one hot year full of Trump tariff wahala, Gaza truce, and hope for peace for Ukraine. For Russia, President Putin talk say di military “heroes” go bring victory for Europe, while Ukrainian President Zelensky talk say dem dey 10 percent close to settle di war. For Sydney, people celebrate New […]

todayJanuary 1, 2026 12 1

obodo oyinbo

Mali, Burkina Faso Block Americans From Dia Country

By: Esther Ayoola Mali and Burkina Faso don place travel restriction on American citizens after di US put dem for no-entry list. Both countries’ foreign ministries tuk say di action na “equivalent measures,” as response to President Donald Trump decision to expand US travel ban reach almost 40 countries dis month. Di US list include Syria, Palestinian Authority passport holders, and some African countries like Niger, Sierra Leone and South […]

todayDecember 31, 2025 7

obodo oyinbo

Guinea Coup Leader Doumbouya Win Presidency With Big Landslide

By: Esther Ayoola Guinea election authority don declare Mamady Doumbouya, di coup leader wey take power for 2021, as winner of di guinea 2025 presidential election. Dem announce di provisional result on Tuesday, say di vote wey happen December 28 give am 86.72 percent, wey make am win straight without runoff. Dis election na di first one for di country since di military takeover, and many observers say e happen […]

todayDecember 31, 2025 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app