obodo oyinbo

135 Results / Page 9 of 15

Background

obodo oyinbo

Zelensky Konfamate Dat Ukraine, Russia, U.S Go Hold First Big Meeting

By: Esther Ayoola Ukraine Presido, Zelenskyy don konfamate say officials from Ukraine, Russia and America go meet for di first time dis Friday and Saturday. According to report, dis meeting go happen for Abu Dhabi, and e go hellep push ways to end di war for Ukraine. Dis one sef dey come afta Zelenskyy tuk with US Presido Trump for Davos, im say security mata sef dem don settle and […]

todayJanuary 23, 2026 7 7

obodo oyinbo

Trump Set Up Board Of Peace For Davos Summit

By: Rilwan Agbomeji US Presido Donald Trump don launch im new Board of Peace for Davos with $1 billion membership fee Leaders from 19 countries, including Trump padi dem from Argentina and Hungary, sign di founding charter. Board suppose dey manage Gaza peace, but e fit settle oda international wahala too, wey dey make people fear say e wan compete with UN.

todayJanuary 22, 2026 8

obodo oyinbo

President Trump Drop Plan To Take Over Greenland

By: Rilwan Agbomeji US Presido, Donald Trump don comot im threat to put tax for European countries wey no like im plan to take over Greenland. E tuk dis one yesterday for Davos wia im hold meeting with leaders for Europe, say e no go use force take di land again, and im dey try do deal wit NATO Secretary-General Mark Rutte. Trump talk say if dem fit agree, e […]

todayJanuary 22, 2026 6

obodo oyinbo

Trump Hail US Economy for Davos, Throw Shade Give Europe

By: Esther Ayoola U.S Presido Donald Trump dis Wednesday afternoon,  don go whine world leaders wetin nor good for davos say  America “ na di economic engine of the world,”. Trump clear di world leaders  say America dey show workings yangayanga, whether na  inflation, dem dey top, investment nkor, say dem don reach trillions of dollars, say America don grow pass di prediction of internation monetary fund IMF. Oga dey […]

todayJanuary 21, 2026 5

obodo oyinbo

Japan Court Give Life Jail sentence To Abe Killer Tetsuya Yamagami

By: Esther Ayoola Japan court don sentence di killer of former Prime Minister Shinzo Abe, wey dem dey call Tetsuya Yamagami, to life in prison. Yamagami bin admit say e shoot Abe for 2022, di mata sef ehn shock di whole Japan. Prosecutor dem tuk say dis crime na “unprecedented” and e get serious effect for society. Yamagami lawyer bin beg make court give am just 20-year maximum punishment, as […]

todayJanuary 21, 2026 7

obodo oyinbo

Beijing Ginjer Afghanistan To Protect Chinese Citizens After Kabul Bomb Blast

By: Esther Ayoola China don send SMS on Tuesday to Afghanistan say, make dem protect Chinese citizens afta bomb blast for Chinese Noodle restaurant for central Kabul, kill seven people. China say dem nor wan hear anytin, protect Chinese citizens ni be di message China Foreign Ministry tuk tuk, Guo Jiakun, tuk say dem don call di Afghan gornment make dem treat dose wey wunjor well and tighten security for […]

todayJanuary 20, 2026 21 16

obodo oyinbo

President Trump Invite Putin To Join Im ‘Board of Peace’ Movement

By: Esther Ayoola Oooh, US presido, Donald Trump dey find trouble sha, say im don invite Russian Presido Vladimir Putin make e join im “board of peace” wey go try solve all di shootie shootie wey dey go on for di world and hellep manage Gaza war. Dis invitation sef dey come, when Russia sti dey war with Ukraine, di mata sef don tey, nearly four years. Trump dey try […]

todayJanuary 20, 2026 13 15

obodo oyinbo

Gun Battle For Syria Afta Army and SDF Sign Ceasefire

By: Esther Ayoola Syria army and Kurdish-led Syrian Democratic Forces, SDF, do small gun battle today, just one day afta dem sign ceasefire to stop weeks of serious fighting wey don chase plenty people commot for dia houses. President Ahmed al-Sharaa say e go meet SDF oga, Mazloum Abdi, on Monday afta bad weather stop am from come meeting before. Even with ceasefire, tension never calm as shooting still dey […]

todayJanuary 19, 2026 10 15

obodo oyinbo

Spain Train Crash Kpai At Least 39 As Rescue Continue

By: Esther Ayoola Say nor be small askident for spain, day Plenty pipo from Huelva, Cartaya, Lepe, and Aljaraque  ni dey miss ontop di mata dat on train crash. Jose Manuel Moreno wey dey in charge of Citizen Security for Huelva even tuk say, im never sti sabi how many pipo don kapi but according to report say at 39 Konfam dead so far as recue dey continue on Monday. […]

todayJanuary 19, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app