Politics

139 Results / Page 4 of 16

Background

OBODO NAIJA

Dino Melaye Mocks Tinubu

By: Mariam Ajayi ADC chieftain Dino Melaye don mock Presido Bola Tinubu over im three-week vacation outside Nigeria. Melaye make di statement as Tinubu travel from Abuja to Europe for im annual leave, according to presidential aide Bayo Onanuga. Onanuga say Tinubu first stop na London, United Kingdom, as part of di vacation.

todayAugust 31, 2026 8

Politics

Atiku: I Go Bring Back Petrol Subsidy If I Win 2027

By: Kofoworola Olayinka ADC presidential candidate, Atiku Abubakar, don talk say e go restore petrol subsidy if e win di 2027 election because Nigerians never see how gornment use di money wey dem save. Atiku talk dis for BBC Hausa interview on Friday while explaining how e wan tackle di hardship wey Nigerians dey face. E say e no oppose di removal of petrol subsidy, but e dey question where […]

todayAugust 28, 2026 18

Politics

Atiku: Na Me Start Opposition Group

By: Kofoworola Olayinka Atiku Abubakar don reject claim say e dey block opposition group ahead of 2027 election, saying na im start di group. E talk dis while e dey push to unite opposition politicians against APC for di 2027 presidential election. Atiku say most of di politicians wey start di group still dey together despite dia gbege, but Peter Obi and Rabiu Kwankwaso don comot. E insist say na […]

todayAugust 28, 2026 15

Politics

President Tinubu and APC Govo Jam Head to correct Campaign

By: Mariam Ajayi Presido Bola Tinubu and APC gofnors don hold closed door meeting for Aso Rock to settle di gbege wey dey happun for di party over 2027 campaign list. Vice Presido Kashim Shettima also meet di gofnors for NEC meeting before dem enter Presido Tinubu office to discuss di mata. Di political palava don dey ground since Wednesday as party leaders dey meet back to back to calm […]

todayAugust 28, 2026 10

Politics

Makinde Pick Anthony Ehilebo As Media Adviser For Im 2027 Campaign.

Oyo State Gofnor and presidential candidate of di Allied Pipo Movement, Seyi Makinde, don appoint Anthony Ehilebo as hin Special Adviser on Media and Digital Communication. Makinde media aide, Sulaimon Olarenwaju, announce di appointment for Ibadan, say e don take immediate effect, while more campaign team appointments go follow. Makinde say Ehilebo’s experience as communication strategist and lawyer go help push APM message and campaign to reset Nigeria ahead of […]

todayAugust 27, 2026 14

Politics

Amaechi Say E Pay Pregnant Women N10,000 for Antenatal

By: Mariam Ajayi ADC presidential running mate, Rotimi Amaechi, don reveal say as Rivers State gorfnor, hin dey give pregnant women N10,000 each for antenatal care to help reduce maternal and child deaths. Amaechi make dis disclosure while explaining say Rivers State rank second for maternal-child mortality during hin time as governor from 2007 to 2015. hin say di payment na part of measures wey hin administration introduce to encourage […]

todayAugust 26, 2026 15

Politics

Makinde Pick Former DSS Oga As Im Running Mate For 2027

By: Kofoworola Olayinka Oyo State Govo and APM presidential candidate, Seyi Makinde, don pick former DSS Director-General, Lawal Daura, as im running mate for di 2027 presidential election. Makinde unveil Daura on Thursday during APM national convention for Bauchi, say e choose am to help tackle Nigeria security challenges. E also promise to lift millions of Nigerians out of poverty and work with like-minded politicians to build better Nigeria.

todayAugust 26, 2026 10

Politics

Atiku Promise Nigerians Beta Life

By: Mariam Ajayi ADC presidential candidate, Atiku Abubakar, don promise say e go strengthen naira and improve Nigerians’ living condition if e win di 2027 presidential election. Atiku make di promise as e insist say im position on bringing back targeted fuel subsidy still remain di same. E say e go restore targeted subsidies and put more purchasing power back for di hands of Nigerians. Atiku, for post on X, […]

todayAugust 26, 2026 7

OBODO NAIJA

Kingibe Accuse Wike Say E Borrow Money For FCT Without Approval

By: Mariam Ajayi FCT Senator, Ireti Kingibe, don accuse FCT Minister, Nyesom Wike, say e dey take loans for Abuja without National Assembly approval. Kingibe make di allegation on Tuesday during interview with one television station, say DMO records show say loans dey taken for FCT between August 2023 and March 2026. She add say Wike never appear before Senate to seek approval for di borrowing.

todayAugust 26, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds