Sport Yarns

112 Results / Page 7 of 13

Background

Sport Yarns

Legend James Milner finally hang boot after playing 20 years plus Premier League

By: Esther Ayoola Former-England international and Liverpool vice capo, James Milner, don announce say he dey re-tire from professional football. Dis one sef na afta im play for Premier League for more than twenty years. Di 40-year-old midfielder, wey many sabi for im utility doings, actually finish im contract afta three seasons with Brighton & Hove Albion. Milner na him hold di record now as di player wey play game […]

todayJune 1, 2026 21

Sport Yarns

Flamingos Fire Guinea 11-0 Aggregate To Enter Final Level Of World Cup Qualifiers

By: Esther Ayoola Naija U17 women national team, di Flamingos, don qualify for di third and final round of di 2026 FIFA U-17 Women’s World Cup qualifiers afta dem beat Guinea wetin nor good. Following dia initial 5-0 win for Abidjan, di girls change am for di second leg inside Ikenne on Sunday as dem wire Guinea 6-0 to finish di match 11-0 on aggregate. Oluwakemi Adegbuyi na him first […]

todayJune 1, 2026 18

Sport Yarns

Osimhen Shut Rumour, Say Im Sti Dey With Gala

By: Esther Ayoola Galatasaray striker Victor Osimhen don clear air, say all di tuks wey dey go round about im future, nor dey anywia. Dis one come afta Super Eagles coach Eric Chelle tuk say Osimhen fit miss Naija friendly games against Poland and Portugal because of possible transfer mata. But Chelle bin try tuk say di striker just need relax afta long season according to di Super Eagles media […]

todayJune 1, 2026 15

Sport Yarns

Super Falcons Land Camp, Ready To Show Senegal Pepper For Friendly

By: Esther Ayoola Super Falcons players don begin baf enter camp for Ikenne, Ogun State, as dem dey prepare for two friendly matches against Senegal before WAFCON. Dis one dey happen after Naija Football Federation (NFF) release di names of 23 players wey di head coach, Justine Madugu, select for di big matches. Top stars like captain Rasheedat Ajibade, goalkeeper Chiamaka Nnadozie, and veteran striker Asisat Oshoala all dey inside […]

todayJune 1, 2026 16

Sport Yarns

Nadal Explain How Wunjury Take Spoil Im Career For Tennis 

By : Jolayemi Olajide Former world number one, Rafael Nadal don open secret yarn of how im take carry  plenty wunjury  throughout im tennis career. Im yarn dis one ontop im  new Netflix documentary wey BBC Sport report on Friday. di 22-time Grand Slam champion tuk say e make hard decisions about im health just to continue winning. According to Nadal, if  to say wunjure nor worry am, e for […]

todayMay 29, 2026 35 2

Sport Yarns

Neymar to Miss Brazil World Cup First Game Say Im Get Injury

By : Jolayemi Olajide Brazil team doctor, Rodrigo Lasmar, don konfamate on Thursday say Neymar fit miss dia World Cup opening match base on small calf wunjury wey im get. According to di Team doctor, Di 34-year-old Santos star don already dey receive treatment after MRI scan show grade two muscle tear and dat im go miss two to three weeks. Neymar land camp on Wednesday but skip training because […]

todayMay 28, 2026 22 1

Sport Yarns

FG Approve Big Rebuild For Sports Facilities Across Naija

By: Esther Ayoola Wi Federal Gornment don approve di rebuilding of sports infrastructure projects across obodo Naija. Dis na according to statement by di National Sports Commission oga, Mallam Shehu Dikko say di tin go touch di rearranging gof Abuja stadium and oda stadium across di obodo Naija. Officials say dis projects na part of efforts to boost youth development, revive sports facilities naija go dey export beta talent for […]

todayMay 28, 2026 20 1

Sport Yarns

Femi Azeez Score Two Goals As Super Eagles Flog Zimbabwe To Enter Unity Cup Final

Millwall forward Femi Azeez shine wetin nor good yesterday for im first match for Naija, as im kpake two goals take help Super Eagles flog Zimbabwe. Di boy sharp like razor blade, im sha  put behind am di pain say im club miss out for Championship play-offs, score first goal inside di first five minutes of di game. Azeez sti come add another goal afta one hour pass, to make […]

todayMay 27, 2026 14

Sport Yarns

American Runner Tell Athletics World Pipo To Beg Amusan Say Dem Doub Her Wrongly

American runner, Kyle Merber, don drop bombshell say all di pipo wey doubt Tobi Amusan world record for 2022 suppose beg di Nigerian girl. Naija star Amusan bin set the 100m hurdles world record for 12.12 seconds during di 2022 World Championships, but big names like Michael Johnson tuk dat time say, na breeze cause am dat time. Dem bin dey complain say track condition, new running shoes, or even […]

todayMay 27, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds