News-auth

697 Results / Page 36 of 78

Background

obodo oyinbo

Japan Court Give Life Jail sentence To Abe Killer Tetsuya Yamagami

By: Esther Ayoola Japan court don sentence di killer of former Prime Minister Shinzo Abe, wey dem dey call Tetsuya Yamagami, to life in prison. Yamagami bin admit say e shoot Abe for 2022, di mata sef ehn shock di whole Japan. Prosecutor dem tuk say dis crime na “unprecedented” and e get serious effect for society. Yamagami lawyer bin beg make court give am just 20-year maximum punishment, as […]

todayJanuary 21, 2026 7

National

NDLEA Gbab 77,792 Drug Offenders, Seize 14 Ton Illegal Drugs

By: Esther Ayoola Report card don show from di Naija Drug Law enforcement Agency, say NDLEA don arrest 77,792 pipo wey dey involve for drug business and dem seize about 14,847 kilogram of illegal drugs for di past five years. Na Retired Brigadier General Buba Marwa tuk dis one to tori pipo, during dia award ceremony for NDLEA headquarters for Abuja on Tuesday. He tuk say all dis arrests and […]

todayJanuary 21, 2026 6

National

Govo Mutfwang Promise Peace, Security as Army Chief Visit Plateau

By: Esther Ayoola For Security matas, Plateau State Govo, Caleb Mutfwang, don go promise say im government go continue to maintain peace, improve security and push development for im state. Mutfwang tuk dis one on Tuesday when Chief of Army Staff, Lieutenant General Waidi Shaibu, visit am for New Government House, Little Rayfield, Jos. Di Plateau govo nor waste time, praise Naija Army and other security agencies for dia strength, […]

todayJanuary 21, 2026 5

National

Minister Of Interior Storm Immigration Office Say No More Extra Payment For Passport

By: Esther Ayoola Omo nor be small heat touch immigration office yesterday, say Minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo, enter immigration office do surprise, cut chain say why dem dey delay passport office for Gwagwalada, Abuja. During di visit, di minister check di VIP and children section, question officials why work no start on time, and tuk with applicants wey still dey wait. According to Minister Tunji Ojo, everything wey dey […]

todayJanuary 21, 2026 8

National

FG Advice Naija Pipo To Joinbodi Hellep Build, Protect Naija

By: Esther Ayoola Federal Gornment don call townhall meeting for Naija pipo, both public and private sector  say make everybody join bodi  to build and protect  di country call Nigeria. Na Oga Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, dey tuk dis one for Naija Reputation Summit 2026 wey hapun for Abuja, wia dem take totori matas on Naija good name. E say di launch of ogbonge movement wey […]

todayJanuary 21, 2026 7

National

INEC Give Go Ahead For Ekiti Governorship Campaign

By: Esther Ayoola Di Independent National Electoral Commission don give go ahead to all political parties to start public campaign for Ekiti governorship election from Wednesday, January 21, 2026. Resident Electoral Commissioner, Dr Bunmi Omoseyindemi, ni dey yarn dis one, say di campaign go finish midnight, June 18, 2026. Im conversate dis one for meeting wey dem hold for Ado Ekiti, gather INEC officials and party leaders tell dem wetin […]

todayJanuary 21, 2026 5

National

DSS Release Ogun Pastor Kayode Olawoye Wey Complain About Gorment

By: Esther Ayoola Afta all di plenty wawa online say di Department of State Services (DSS) don finally release one  Pastor, Kayode Olawoye wey dem bin arrest for Ogun State since Monday. Him family confirm say DSS don release am on Tuesday. Say di DSS bin arrest dis Pastor, Olawoye dat im come out for internet begin complain about how some roads for Ogun State don kpafuka, dat gornment nor […]

todayJanuary 21, 2026 4

Lagos

Ministry Of Solid Mineral Explain Say Lagos Gold Refinery Na Private Project

By: Esther Ayoola Di Ministry of Solid Minerals Development don clear air say no be true tuk, say gornment build gold refinery for Lagos, wey go violate federal character principle. Northern Elders Forum (NEF), through dia tuk tuk, Professor Abubakar Jika Jiddere, yarn on Monday say, di refinery wey dey Lagos dey unfair to North. But di ministry, through Special Assistant on Media to di minister of solid minerals, Segun […]

todayJanuary 21, 2026 12

Lagos

Lagos Gornment Advice Lagosians To Check Before Drinking Water

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don warn residents make dem stop using unsafe water, say e dey dangerous to health and environment. Executive Secretary of Lagos State Water Regulatory Commission, Oluwabukola Adeyemo, tuk dis one for one community meeting with water stakeholders for Epe. She say many water wey Lagos get no dey drinkable, unless dem treat am wella because of salt, dirty substances and heavy metals. Adeyemo warn […]

todayJanuary 21, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app