News-edi 1

1366 Results / Page 21 of 152

Background

Sports

Super Eagles Coachie Chelle Tell Players To Do Beta

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles coach, Eric Chelle, don change am for im players tell dem say, make dem nor repeat that anyhow character wey dem do against Tanzania with anybody E say, even though super eagles win 2 goals to 1 on Tuesday, say super eagles suppose do beta But sha im go manage di three point, but moving faward, na only beta football e want to dey see […]

todayDecember 24, 2025 8

foreign

Russia Use Drone Take Attack Ukraine

By: Rilwan Agbomeji Zaporizhia oga talk say Russia don launch 704 air attack, including 17 air strike, for Zaporizhia area for di past 24 hours, wey don kill one person and injure three for December 24, 2025, for Ukraine. Ukraine officials talk say overnight drone attack don hit Moscow, wey even start industrial fire for Tula region wey dey south of Russian capital, as retaliation for wetin Russia don do. […]

todayDecember 24, 2025 9

Sports

AFCON – Naija Super Eagles Show Workings Beat Tanzania 2-1

By: Rilwan Agbomeji Nigeria don start dia AFCON 2025 campaign well, as Super Eagles beat Tanzania 2-1 for Stade de Fez, as Semi Ajayi and Ademola Lookman score. Tanzania try fight back, even score one, but Lookman quick reply make Nigeria take all three points. With dis win, Nigeria dey top Group C join with Tunisia wey beat Uganda 3-1 while Tanzania go need beta result next match.    

todayDecember 24, 2025 9

National

Nigeria Joinbodi With Tech Giants To Take Down Terror Social Media Accounts

By: Rilwan Agbomeji Nigeria gorment talk say security agencies dey work with social media big companies to shut down terrorist and criminal networks online. Director-General of National Counter Terrorism Centre, Maj-Gen. Adamu Laka, yarn dis during end-of-year briefing for Abuja. E talk say platforms like TikTok and Facebook don dey used to promote bad operations and raise fund for terrorists.

todayDecember 24, 2025 13

National

Senate Pass Tinubu ₦58.47trn 2026 Budget For Second Reading

By: Rilwan Agbomeji Na big step wey Senate don take pass President Bola Tinubu ₦58.47 trillion 2026 budget for second reading. Senate Leader, Opeyemi Bamidele, talk say di budget go help consolidate reforms, stabilize economy, and boost public finances. Say like dis like, di bill don waka go Appropriations Committee make dem check am well before final approval.  

todayDecember 24, 2025 7

Lagos

Lagos Police Deploy 5,000 Officers, Say Make Dem Tackle Jaguda Boys

By: Rilwan Agbomeji As Lagos dey prepare for chrismas and new year di State Police Comand say dem dey tighten security across di state including di water ways. Say like dis dem don deploy 5000 security officers to make sure say residents and di state dey safe. Na for inside strategic management meeting wey dem do, Police Commissioner,  Moshood Jimoh share di updates say dem don ready dia rake, an […]

todayDecember 24, 2025 6

foreign

Lionel Messi Sister Enter Hospital Afta Car Crash

By: Rilwan Agbomeji No be small thing ooo say Argentine superstar, Lionel Messi sister, Maria, get motor crash and like dis like dis, dem don dey drag her mata inside hospital for Miami. Report say all of a sudden she lose control, jam wall as at di time wey pipo rush reach there, she don already pass out Later aproko pipo report say she break her heel, wrist and get […]

todayDecember 23, 2025 10

foreign

Russia Attack Ukraine, Kill 1 Pikin And 3 Others

By: Rilwan Agbomeji  At least three people don kpai, including one four-year-old pikin, as Russia launch new attacks for Zhytomyr region and other parts of Ukraine. According to Ukraine Energy Ministry, Plenty pipo wunjure as Russia target energy facilities across di country. Emergency power cuts don start for some areas, including Kyiv and nearby regions, to manage di gbege.

todayDecember 23, 2025 5

National

US Open Door Launch Immigration Plan

By: Rilwan Agbomeji US Department of Homeland Security don announce new plan wey go pay $3,000 to migrants wey waka go by themselves. Any undocumented migrant wey register through CBP Home app before end of year go fit collect di cash plus free flight back home. DHS talk say dem go still forgive any fines or penalties wey migrants dey owe for not comot earlier. Di programme get limited-time offer […]

todayDecember 23, 2025 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app