News-edi 1

1469 Results / Page 30 of 164

Background

National

Kwankwaso, Sanusi Matter Spark Fresh Wahala For Kano

By: Rilwan Agbomeji Fresh gbege don sup for Kano say Former Govnor Rabiu Kwankwaso tell members of New Nigeria People’s Party (NNPP) make dem pledge loyalty to reinstated Emir of Kano, Lamido Sanusi. Dis one no sit well with deposed Emir, Aminu Ado-Bayero, as e quickly fire back. U sabi say, On 23 May 2024, Kano State Governor, Abba Yusuf, remove Ado-Bayero as Emir afta State House of Assembly cancel […]

todayDecember 25, 2025 9

Sports

Valencia Eye Emmanuel Dennis As Dem Dey Find Striker

By: Rilwan Agbomeji E be like say Spanish club, Valencia dey plan move to sign free agent Emmanuel Dennis. Dennis wey Nottingham Forest release for summer don dey attract interest from different clubs for Europe and Asia. According to reports, Valencia don put di Super Eagles forward for dia watchlist as dem dey find better striker. Valencia season no dey sweet at all as dem dey sit for 17th position […]

todayDecember 25, 2025 8

foreign

Pope Leo Xiv Beg Russia, Ukraine Make Dem End War

By: Rilwan Agbomeji Omo Pope Leo XIV carry mata dey clear Russia senior men and Ukraine senior men say make dem get sit down face-to-face talk how to end di war for Ukraine. Speaking for St Peter’s Square Christmas message oh, e pray specially for Ukraine people and call for unity and support for people wey dey suffer across Europe. Di Pope also talk say war no be beta tin […]

todayDecember 25, 2025 8

Sports

Super Falcons Star Esther Okoronkwo Share ₦200k Cash Gifts

By: Rilwan Agbomeji Super Falcons Striker Esther Okoronkwo don spoil area with Christmas gift, show love, surprise people for Abia State with cash gifts. Na for one video wey she post for Instagram on Christmas Day, na a aproko pipo go gbab say,  Esther dey share money give drivers, traders, shoppers and people wey dey road for Umuahia. Di Abia-born footballer, wey dey play for AFC Toronto for Canada, say […]

todayDecember 25, 2025 14

National

EFFC Boss Drop Yanings Say Corruption Dey Block God Blessings For Nigeria

By: Rilwan Agbomeji Chairmo of EFCC, Ola Olukoyede, don open di secret finally oh, say  na corruption dey block God blessings wey suppose reach Nigeria. Im tuk dis konfam tuk for im Christmas message say, na corruption dey stop di country make e reach full potential. Olukoyede beg Nigerians make dem join hand fight corruption to make Nigeria strong, rich and respected. Im call on everybody make dem waka together […]

todayDecember 25, 2025 10

Lagos

Govnor Sanwo-Olu Give Update On GNI Building Fire

By: Rilwan Agbomeji Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don break silence on di fire wey shake Great Nigeria Insurance Building for Martins Street, Lagos, oga go see di place, dey beg people make everybody calm down. Sanwo-Olu yarn dis one through Information Commissioner, Gbenga Omotoso, for statement wey im drop Thursday. Sanwo-Olu say emergency teams don control di fire and situation dey under check. Good news be say no single […]

todayDecember 25, 2025 11

Sports

Coach Gamondi Say Tanzania Sabi Ball Pass Nigeria

By: Rilwan Agbomeji Tanzania coach Miguel Gamondi talk say e still dey happy small with how im team play, even though dem lose 2–1 to Nigeria for AFCON match on Tuesday. Na Nigeria score first through Semi Ajayi, before Charles M’mombwa equalise for Tanzania early second half. But celebration no last as Ademola Lookman quickly score winner give super eagles, while Tanzania still dey find dia first AFCON win.   […]

todayDecember 25, 2025 25

foreign

How Yemen Govment & Houthi Agree To Release Thousands Prisoners

By: Rilwan Agbomeji Yemen govment and Houthi group don agree to free plenty prisoners afta about two weeks of peace talk for Muscat, Oman. Dis na according to statement wey UN special envoy Hans Grundberg release. Houthi official Abdulqader al-Mortada talk for statement wey e post on x say dem agree to exchange 1,700 Houthi prisoners for 1,200 govment side, including Saudi and Sudan people.  

todayDecember 25, 2025 8

National

Suicide Bomber Kill 5, Injure 35 For Ngamboru Market Mosque, Maiduguri

By: Rilwan Agbomeji Five people don kpai and 35 odas don get different kain injury afta one teen suicide bomber blow imself for mosque inside Ngamboru market, Maiduguri, during evening prayers on Wednesday. Eyewitness talk say di blast happen around 6:10pm when plenty traders dey worship before dem go house, and e make fire plus thick smoke burst for mosque ceiling. Di explosion scarra wetin nor good for di crowded […]

todayDecember 25, 2025 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app