News-edi 1

1355 Results / Page 4 of 151

Background

Sports

Adesanya Say E Nor Dey Enter Go Boxing

By: Rilwan Agbomeji UFC former two-time middleweight champion Israel Adesanya don share update on how im wan waka, say e nor go switch go boxing afta e finish for mixed martial arts (MMA). E yarn dis one during one Question & Answer session for Thailand, say e wan finish e career for UFC. Adesanya tuk say, e bin think about boxing small because of money, but e feel say MMA […]

todayJanuary 8, 2026 4

National

Senator Oshiomhole Jim Jim Di Bodi For Okpekpe 10km Race

By: Rilwan Agbomeji Na former Edo State Govnor and current senator for Edo North, Comrade Adams Oshiomhole, say im don dey do jim jim di bodi for Okpekpe International 10km Road Race wey go hapun for May 2026. For one video wey don spread like kolta, Oshiomhole show as e dey waka train with im Okpekpe white T-shirt, show say e cover 8.92km for 85 minutes and burn 492 calories. […]

todayJanuary 8, 2026 8 4

National

NERC: Togo, Niger, Benin Dey Owe Naija N25bn Gbese For Electricity

By: Rilwan Agbomeji Nigerian Electricity Regulatory Commission (NERC) don share update say Togo, Niger, and Benin dey owe Nigeria about N25 billion for electricity wey dem buy from Nigeria grid. NERC tuk dis for dia Third Quarter 2025 report, wey show say di three countries suppose pay $18.69 million but dem don only pay $7.125 million, leaving $11.56 million unpaid. Di regulator explain say di debt dey because these international […]

todayJanuary 8, 2026 7

National

Court Put Ice Block For Malami, Sons 57 Properties

By: Rilwan Agbomeji Federal High Court for Abuja don order make government hold 57 properties wey dem say get link with former Attorney-General, Abubakar Malami, and two of im pikin dem, Abdulaziz and Abiru-Rahman. Justice Emeka Nwite give di order afta EFCC carry ex parte application come court on Tuesday. EFCC talk say di properties, wey value reach about N213.2 billion, be money from illegal activities. Dem say di properties […]

todayJanuary 8, 2026 9 4

National

Govnor Makinde Arrange Im Mehn To Rascal Di Jaguda Boys Wey Attack Oloka

By: Rilwan Agbomeji Oyo State Govo, Seyi Makinde, don condemn di attack wey kill five forest guards for Oloka Village. E talk say di people wey do am go dance ayagayagayagayo, face justice. Di Govo press tuk say na cross-border attack ni hapun, and security agencies don dey work to catch di criminals. E beg residents, especially for Oriire LGA and border areas, make dem remain calm as normalcy don […]

todayJanuary 8, 2026 5

Sports

How Di Morocco 2025 AFCON Waka So Far

By: Rilwan Agbomeji Di battle for di 2025 Africa Cup of Nations (AFCON) dey strong by every match day,  beta performances for all di top teams, and high hopes from every corner of Africa. And like dis, di tournament don reach Quater finals phase. Na 52 African countries enter di race from di qualifiers to di group stage of di competition.   Group Stage Results – AFCON 2025 (Morocco) Matchday […]

todayJanuary 8, 2026 4 3

Sports

Super Eagles Refuse to Travel Say Dem Never See Dia Match Bonus

By Ebi Oboko Nor be small tin oh, say di Super Eagles of Nigeria and coaches no gree travel to Marrakech wia dem suppose face Algeria for AFCON quarterfinals say NFF never pay dem dia Four match bonus. Africa Aproko Journalist, Oluwashina Okeleji, ni troway dis update for Instagram, say na wetin hapun on Wednesday, normal dem supposr travel on Thursday, today from FEZ b4 dis news dey break so. […]

todayJanuary 8, 2026 6

foreign

U.S Take Over Venezuela Oil Money

By Ebi Oboko US  say dem don dey control Venezuela oil sales and dat,  na dem go  decide how Venezuela go take spend dia money. US Department of Energy na dey troway dis one for social media, say dem don even start to sell the oil for world market, and all the money go first enter bank accounts wey US dey control. Dem say, dem don succeed sell about 30 […]

todayJanuary 8, 2026 5

National

NLC Presido knack Akpako Untop New Tax Law

By Ebi Oboko Oga Presido of Nigeria Labour Congress, Joe Ajaero, don knock the new tax law,  say,  workers nor sabi wetin dey hapun and dat e go put more load on poor pipo. E tuk dis one for Abuja during book launch of former NLC presido Hassan Summonu and im 85th birthday celebration. Ajaero say gornment sideline workers for di tax reform marra, even though na dem dey pay […]

todayJanuary 8, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app