News-edi 1

1452 Results / Page 4 of 162

Background

obodo oyinbo

Ukraine Former Energy Minister Galushchenko Land Police Net For Corruption

By: Esther Ayoola Former Ukraine energy minister German Galushchenko don land police net as im dey try japa from di country. U sabi say, e leave gornment last year afta e name show for corruption list. E dey among people wey dem tuk say, dem collect $100m for November embezzlement scandal. Say di mata sef shake President Volodymyr Zelensky gornment wey promise to fight corruption before Russia attack, so like […]

todayFebruary 16, 2026 4

obodo oyinbo

Israeli Soldiers Kpai 11 Palestinians For Gaza, Including Pij Commander

By: Esther Ayoola Israeli soldiers don kpai kpai at least 11 Palestinians for different parts of Gaza, According to hospital authorities, For Jabalia camp, dem hit tents wey displaced people dey, kill five. For Khan Younis, another five people Kpai. Say Dem also kill PIJ commander Sami al-Dahdouh for Tal al-Hawa, east Gaza City, say, di mata, na every day e dey worwor for Gaza.

todayFebruary 16, 2026 3

National

Naija and Angola Sign Visa-Free Deal

By: Esther Ayoola Naija and Angola don sign one agreement wey go hellep Nigerians wey get diplomatic or official passport, waka in an out of Angola  without visa. Di deal hapun for Addis Ababa during African Union 39th Ordinary Session. Naija Minister of Foreign Affairs, Amb Yusuf Tuggar, wey attend di event, say, dis na big step to make cooperation between both countries strong. Dat E go also make official […]

todayFebruary 16, 2026 3

National

NASS Cut Break Short To Shift 2027 Presidential Election Date

By: Esther Ayoola National Assembly say dem wan cut short dia break and resume plenary on Tuesday, February 17, 2026, by 11am, dat important tuks dey to tuk for di 2027 election matas. Say, like dis Clerk to di National Assembly, Kamoru Ogunlana, don wire bulk SMS to all  senators and House of Representatives members make dem adjust dia timetable because of  di meeting on Tuesday. Konfam news Sources inside […]

todayFebruary 16, 2026 3

National

VP Shettima Arrange Bodi With FG Team To Visit Kano Fire Victims

By: Esther Ayoola Vice President Kashim Shettima go lead one Federal Gornment team go Kano afta fire burn Singa Market last weekend. Say, Di team dey go show di President sympathy to traders wey lose billions of naira for di fire. Among di team na Naija House Speaker, Tajudeen Abbas, Deputy Senate Presido, Barau Jibrin, Kawu Ismaila, and Abubakar Kabir Bichi wey be Chairman of House Committee on Appropriations.

todayFebruary 16, 2026 2

National

Peter Obi Call Nigerians To Join Hand To Rescue Naija

By: Esther Ayoola Di labour Parti presidential candidate for di 2023 elections, Peter Obi,  don put wait, dey  call on Nigerians like dis, to hellep join hand to rescue di country from many years of bad governance. Di former Anambra State govo, tuk dis tuk for Uyo during di OBIDIENT Conference as dem declare African Democratic Congress, say, na “Operation Rescue Nigeria”. Obi beg say, make everybody forget dia differences […]

todayFebruary 16, 2026 2

National

Oyo APC Make Move To Select Party Leaders Ahead Of Parti Congress

By: Esther Ayoola Stakeholders of All Progressives Congress for Oyo State don joinbodi agree say dem go use hand select dia new executive members for ward and local gornment levels wey go run party affairs for next four years. For statement wey State Publicity Secretary, Adewale Sadare, release for Ibadan on Sunday, e say dem go follow di guideline wey national leadership drop for di parti congress. Dem don fix […]

todayFebruary 16, 2026 3

National

OAU First Ladies Hail Oluremi Tinubu For Girl-Child Support

By: Esther Ayoola Naija First lady, Oluremi Tinubu don receive honour from Organization of African First Ladies for Development say, she ma try for girl-child education, hygiene, and health for mothers and childrensis for Naija. Dem give am di recognition for di 29th and 30th General Assembly for Addis Ababa, where dem also praise her effort to reduce mama and pikin death rate. In her acceptance, Di First Lady wey […]

todayFebruary 16, 2026 2

Lagos

Lagos Gorment Plan Move To Return Monthly Sanitation

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don announce say monthly sanitation exercise fit return to di state cause say di way di state tey dey smell nor be small. Di Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, tuk dis one afta im inspect Lagos Island on Sunday untop di dirty mata. Wahab tell tori pipo say, di gornment dey do everytin within dia power to bring back di exercise […]

todayFebruary 16, 2026 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app