News-edi 1

2592 Results / Page 6 of 288

Background

OBODO NAIJA

Wike Deny Say He Rig 2023 Election For Tinubu

FCT Minister, Nyesom Wike, don deny allegate say e rig 2023 presidential election for South-South to favor Presido Bola Tinubu against Labour Party candidate, Peter Obi. Wike tok dis one for TV siddon tok with tori pipo for Abuja, on Wednesday say dat allegate na anyhow tok wey no hold water, say na just social media gist wey dey spread. E say di election results come from strategy wey dem […]

todaySeptember 24, 2026 15

Lagos

Lagos Gornment Gbab One Man Wey Allegedly Abuse Toddler

Lagos State Gornment don confirm say police don arrest one man wey dem accuse of abusing one small pikin for Ikorodu, as e dey police custody while investigation dey go on. Lagos State Domestic and Sexual Violence Agency, DSVA, say dem arrest di suspect on Wednesday, September 23, 2026, one day after dem alert di agency about di viral report of di alleged child abuse. DSVA say immediately dem receive […]

todaySeptember 24, 2026 15

Sports

Referee Abdulsalam Go Officiate U-17 World Cup For Qatar

By: Mariam Ajayi Nigerian referee Kasimu Abdulsalam don get FIFA appointment as one of di match officials for di 2026 FIFA Men’s U-17 World Cup. Dat one na di match wey go happun for Qatar from November 19 to December 13. Abdulsalam na di only Nigerian among 81 referees and assistant referees wey FIFA select for di tournament. Di 34-year-old referee, wey become FIFA-listed official for 2022, don reach another […]

todaySeptember 23, 2026 17

OBODO NAIJA

Tinubu Reforms Dey Make Airfares Come Down

By: Mariam Ajayi Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo, say Tinubu reforms for aviation sector don make airfares come down. E tuk say  dis move don attract new airlines plus aircraft enter Nigeria market. Keyamo talk this for Abuja as Naija aviation market now rank fourth-largest for Africa, with more than 18.8 million domestic and international passengers recorded for 2025. FAAN say di figure represent 11.9 per cent […]

todaySeptember 23, 2026 13 14

Lagos

Suspected Cultists Kpai One Man For Ikorodu

By: Mariam Ajayi Suspected cultists allegedly , don go kpai persin, wey name na  Tosin.  after dem rob am for Egbin area of Ijede, Ikorodu, on Tuesday, September 15. Tosin reportedly, just  travel from Ondo State come attend one event for the community, as im just comot di party go one side na dis badness hapun. According to  source say some Jagudas  allegedly attack am, collect im gold chains, mobile […]

todaySeptember 23, 2026 14

obodo oyinbo

Iran Oga Dem Dust Dia Shoe, Waka Comot For UNGA

By: Rilwan Agbomeji Iran officials and members of dia delegation don waka comot out of di UN General Assembly, as dem reject US Presido, Donald Trump’s threat to destroy Iran if Tehran no agree deal with Washington. Trump make di threat during im speech for di 81st UN General Assembly for New York, where e defend di US military campaign against Iran and warn say e fit escalate di conflict. […]

todaySeptember 23, 2026 17

OBODO NAIJA

Federal Gornment Nor Give Me 50 Billion Naira – Seyi Makinde

Oyo State Govo, Seyi Makinde don accuse Federal Capital Territory Minister, Nyesom Wike say he dey drop banga. Makinde tok dis one on Tuesday for Makinde/Daura 2027 Presidential Town Hall meeting for Katsina, say Oyo State Gornment no receive any N50bn from di Federal Gornment, say na di state gornment use dia money take upgrade di Ladoke Akintola International Airport for Ibadan. Remember say, Wike do interview with tori pipo […]

todaySeptember 23, 2026 15

obodo oyinbo

Iran Cancel Flights To Iraq And Oman

Iran don cancel flight go Baghdad for Iraq and Muscat for Oman from midnight on Tuesday, just hours before US  punishment against Iran go start. Tok tok pesin for Iran civil aviation tell media tok tok pipo say Baghdad and Muscat airports no go accept Iran flight again, but flight to other area like Istanbul go continue normal  normal. Iran flight oga dem dey follow Iraq yarn to move Baghdad […]

todaySeptember 23, 2026 25

Sports

Mbappe Miss Training As Sickness Worry Am

France captain Kylian Mbappe miss training on Tuesday after sickness wey resemble flu catch am, double mind don dey weda e go play di coming Nations League games. Di Real Madrid player remain for France training camp as new coach Zinedine Zidane dey train di rest of di squad. French Football Federation konfamate say Mbappe nor come because of di sickness, but dem never talk when e go come back. […]

todaySeptember 23, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds