News-edi 1

2593 Results / Page 58 of 289

Background

Sport Yarns

Roberto Martinez Hail Eric Chelle, Say Him Workings Dey Show 

By : Shalom Ovie Portugal coachie,  Roberto Martinez, don talk say e dey impressed with Super Eagles coachie, Eric Chelle, as e dey build im own football style for Nigeria side. Martinez talk dis one for him pre-match interview before di match, say Nigeria na strong side and Chelle don give dem clear football identity wey dey show. Even though some key players no dey, Martinez still talk say Nigeria […]

todayJune 11, 2026 15

south west

Stage Collapse For Inside Osun State as Adeleke Dey Do Rally

By : Jolayemi Olajide For Inside Osun State, fear gbab everybody on Wednesday, as di stage wey Osun State Govo, Ademola Adeleke and other big men dem dey use for rally burst enter ground for Ijebu Jesa. Dis particular gbege dey for inside 30 seconds video wey tori pipo collobi during di rally. Inside di video, musicians still dey perform for stage when di MC wan announce di next thing […]

todayJune 11, 2026 14

Politics

Bashir Ahmad throw jibe on Obi And Kwankwaso say dem Go still commot NDC

By : Jolayemi Olajide Bashir Ahmad don throw jibe for Peter Obi and Kwankwaso, make dem chest am, say if thins nor go as plan, dat dem go sti comot Nigeria Democratic Congress after di 2027 election Im post for X say the duo just dey look NDC as commercial vehicle to take enter power. According to am, party leader Seriake Dickson dey play long-term for 2031, why Obi dem […]

todayJune 11, 2026 19

Entertainment

Davido Carry Oyo Kidnap mata to FIFA Stage

By : Jolayemi Olajide Afrobeats superstar Davido don carry Naija security mata enter global level, as im use di FIFA World Cup countdown concert to tell Nigeria gorment to go an rescue the students and teachers wey bandits pack for Oriire LGA, Oyo State. OBO rock one bad black leather jacket wey full with green buttons, and every single button carry the name of the victims to show di world […]

todayJune 11, 2026 21

Sports

Portugal Beat Super Eagles

Nigeria super eagles fall hand and leg go  lose 2-1 to Portugal for international friendly match. Pedro Neto open naim open di scoring for Portugal before Akor Adams equalise for Super Eagles to make am 1-1. Later, substitute Francisco Conceição bend one fine shot enter net to restore Portugal lead and seal di win. Di result mean Portugal go enter di World Cup with back-to-back victories.

todayJune 11, 2026 20

obodo oyinbo

US, Iran Exchange Blow

US Presido Donald Trump, don cut chain say United States go hit Iran “hard” again after both sides exchange strikes overnight. Di white house presido put dis one for X, say dis action na based on say Iran go shoot down US Army helicopter. Iran President Masoud Pezeshkian respond for X say Iran go stand firm against any pressure or threat from America, showing say dem no go back down. […]

todayJune 11, 2026 20

OBODO NAIJA

Bad Boys Storm Kogi, Kpai School VP, Kidnap Students

Armed bad boys don storm Iluke community for Kogi on Wednesday morning, kpai three people join school VP. Di gunmen operate for hours, dey shoot scatter-scatter to tension di whole town. Dem come pack students wey wan write WASSCE English paper run enter bush. Residents don enter heavy mourning, dey beg government for sharp-sharp security help to rescue di kids.

todayJune 11, 2026 21

OBODO NAIJA

Senate Vex Order Kyari Arrest

For Abuja, Senate Committee on Public don order security agencies make dem arrest former NNPCL Group Chief Executive Officer, Mele Kyari, after e fail appear before di committee hearing. Committee Chairmo, Senator Ibrahim Dankwambo naim lead di session wey dey touch light di allegation about ₦210 trillion wey miss road between 2017 and 2023. Some lawmakers say, make dem give Kyari anoda chance because reports say e dey Germany for […]

todayJune 11, 2026 13

Lagos

IKOSI-KETU Pipo Cry Out Over Cost of Living

Normally na di duty of every gorment of a country to balance tins, for citizen to survive, however e be like water don pass garri for obodo Nigeria. Complain here and there, unto di rising cost of living, konfam news tatafo, Esther Ayoola enter di street of Lagos, to tell us, how Lagos dey cope with di new cost of living.

todayJune 11, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds