News-edi 1

1452 Results / Page 6 of 162

Background

obodo oyinbo

China Sharply Blast Israel Move To Grab Palestine West Bank

By: Rilwan Agbomeji China don yarn serious gbege say dem no gree make anybody waka enter Palestinian land, days afta Israel Security Cabinet approve move to grab more West Bank. Lin Jian from China Foreign Ministry talk say dem dey oppose any new settlement for Palestinian area and anybody wey wan chop dia land. On Sunday, Israel Cabinet don give green light make dem build more settlements wey plenty people […]

todayFebruary 12, 2026 9 2

National

Umahi: I Go Resign If Abuja–Kaduna–Kano Road No Meet Standard

By: Rilwan Agbomeji Minister of Works, David Umahi, don go rake full newspaper say e go resign if dem find say Abuja–Kaduna–Kano Road project no meet standard. Umahi yarn dis one on Wednesday as e dey defend im budget before joint session of National Assembly. Some lawmakers question why dem give part of di contract to one company wey dem say no too dey known for road construction and wey […]

todayFebruary 12, 2026 4

Lagos

One Man Kpai, Wife Wunjure As Truck Crush Dia Car For Lagos

By: Rilwan Agbomeji One man don kpai on Thursday morning, while im wife wunjure as truck wey dey carry granite jam dia car for Eleko Junction, Lekki–Ajah Expressway, Lagos. LASTMA talk say di truck wey full ground with granite dey rush from Epe side, dey move with top speed. Brake failure make di truck lose control sharply, dash enter di Toyota wey dey go Epe from Ajah. Di gbege cause […]

todayFebruary 12, 2026 10

Sports

CAF Send Technical Team Go Check Tanzania, Uganda, Kenya For 2027 AFCON

By: Rilwan Agbomeji CAF don send team of technical people go check stadiums and oda facilities for di three countries wey go host 2027 Africa Cup of Nations, Tanzania, Uganda, and Kenya. Dem win di bid wey dem dey call PAMOJA 2027, pass di joint bid wey Nigeria and Benin Republic put. Untop yarnings with tori pipo, CAF Presido, Patrice Motsepe say AFCON go come every four years afta 2028, […]

todayFebruary 12, 2026 8

National

APC, NNPP Question U.S. Over Visa Ban Wey Dem Wan Put For Kwankwaso

By: Rilwan Agbomeji All Progressives Congress (APC) and New Nigeria Peoples Party (NNPP) don reject di proposed visa ban and asset freeze wey some US lawmakers wan place on former Kano governor, Senator Rabiu Kwankwaso, plus Miyetti Allah groups over alleged religious freedom violations. Di bill wey dem call “Nigeria Religious Freedom and Accountability Act of 2026” na Rep Chris Smith and some oda US lawmakers sponsor am, and dem […]

todayFebruary 12, 2026 4

Lagos

Police To Mount Emergency Desk For Inside Lagos Hospitals And Tertiary Schools

By: Rilwan Agbomeji Lagos State Commissioner of Police, Olohundare Jimoh, don talk say dem dey plan to put police desk for all state govment hospitals and tertiary schools for Lagos. Jimoh yarn dis one for Lagos Campus Security and Safety Summit 1.0 wey Ministry of Tertiary Education and Govnor aide on Students’ Union Affairs organise for LASU College of Medicine, Ikeja. Im say di move go help stop delay wey […]

todayFebruary 12, 2026 3

Sports

Chukwueze Enter Nomination For Fulham Goal Of Di Month Award

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles winger Samuel Chukwueze don get nomination for Fulham Goal of di Month award for January. Dem nominate am because of di goal wey e score for Fulham 2–1 win against Brighton, as e equalize for 72nd minute afta fine control of Joachim Andersen pass. So far, Chukwueze don record five goals and two assists from 11 league matches for di Cottagers. Di 26-year-old wey join […]

todayFebruary 5, 2026 9 1

Sports

Lookman Ask Make Dem Transfer Am Go Athletico Madrid — Palladino

By: Rilwan Agbomeji Atalanta coach Raffaele Palladino don reveal say na Ademola Lookman ask make e comot di club go Atletico Madrid. Lookman complete permanent transfer to Diego Simeone side on di last day of winter transfer window. Atalanta collect €40 million as transfer fee for di Super eagles striker. Palladino talk say Lookman receive di offer towards di end of transfer session, say e want new environment, so di […]

todayFebruary 5, 2026 13 1

Entertainment

Nollywood Actress, Aunty Ajara, Kpai Afta Short Illness

By: Rilwan Agbomeji Nollywood actress Ajara Lasisi, wey people sabi as Aunty Ajara, don kpai. Dem announce di sad news on Thursday as Nollywood director Tobi Oladele Teemony, wey dem dey call Tee Mony, share statement for Instagram. According to am, Aunty Ajara kpai overnight afta long time wey she dey battle serious illness with strong mind. Teemony talk say during her sickness, she receive plenty love, prayers, and financial […]

todayFebruary 5, 2026 21

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app