News-edi 1

2592 Results / Page 7 of 288

Background

Sports

20 Super Eagles Players Don Reach Camp For AFCON Qualifiers

Twenty Super Eagles players don reach camp for Ikot Ekpene ahead of dia 2027 AFCON qualifying matches against Madagascar and Guinea-Bissau. Di team open camp on Monday for Four Points by Sheraton Hotel, Ikot Ekpene, with coach Éric Chelle, im assistants and other backroom staff among di first people wey arrive. Captain Wilfred Ndidi, Samuel Chukwueze and goalkeeper Stanley Nwabali dey expected to join di team later today, while dem […]

todaySeptember 22, 2026 16

obodo oyinbo

Gunman Open Fire For Turkey School, Wunjure 11 Pipu

One Gunman open fire outside one high school for Manisa, western Turkey, on Tuesday morning, as 11 pipu wunjure and two of dem dey critical condition. Police don gbab one 15-year-old boy wey dem suspect say na im shoot, while dem also hold im parents and granpapa, wey dem say get di gun. Di shooting happen outside di school before di suspect run comot from di place. Dis one na […]

todaySeptember 22, 2026 13

OBODO NAIJA

FG Give Committee Free Hand To Torch Light Di Death Of 37 Pipu For Niger

Federal Gornment don give di 10-pipu committee full hand to touchlight how 37 pipu wey Nigerian Security and Civil Defence Corps gbab for Niger State take kpai on Thursday, September 17. Interior Minister, Olubunmi Tunji-Ojo, tok dis one for Abuja on Tuesday, September 22, saying di committee fit bring experts, check documents and facilities, visit places connected to di matter. E say di committee fit also ask members of di […]

todaySeptember 22, 2026 17

Lagos

Lagos Gornment Promise Safer Schools For Childrensis

Lagos State Gornment say e dey renew im commitment to make sure say, schools dey safe for childrensis and protect dem from abuse, fear and other forms of jaguda. Na di Commissioner for Lagos State Ministry of Basic and Secondary Education, Hon. Jamiu Tolani Alli-Balogun, tok dis one on Tuesday, September 22, saying schools suppose be places where childrensis dey feel safe, valued and protected as dem dey learn and […]

todaySeptember 22, 2026 14

Lagos

Police Gbab Suspected Cultist For Ikorodu

Di Lagos State Police command don gbab one suspected cultist, 36-year-old Muyideen Olatunbosun, during anti-crime patrol for Idi-Iroko, Ogolonto and Agric area of Ikorodu. Police gbab am as dem dey do patrol for that side, collobi better informate on top some doings,  kon stop and search di suspect body, na so dem see one rubber-made pistol, one axe, criminal charms and one hard drug wey dem call “Ice”. Di suspect […]

todaySeptember 22, 2026 15

OBODO NAIJA

Anyim Say Tinubu No Need Dey UNGA Every Time

Former Senate Presido, Pius Anyim say Nigerians know say Presido Bola Tinubu dey on short leave, as e defend di Presio absence from di ongoing United Nations General Assembly for New York. Anyim tok dis one on Monday, say Tinubu fit send Vice Presido, Kashim Shettima to represent Nigeria for di UN meeting. E say UNGA no be only di main General Assembly, as e say UNGA no be only […]

todaySeptember 22, 2026 18 32

OBODO NAIJA

Federal Gornment Say NEPA Bill Nor Go Increase

Minister of Power, Joseph Tegbe, tok on Monday for Abuja say Federal Gornment no get plan to increase electricity tariff, as gornment dey focus to improve power supply and fix problems for di electricity sector. Tegbe make dis statement for media meeting for Abuja to mark im first 100 days for office, covering June 8 to September 16, say gofment no wan put extra money on NEPA bill. He say […]

todaySeptember 22, 2026 14

Sports

Peter Fury Warn Say Joshua Fit Knock Out Tyson Fury

Peter Fury, wey be Tyson Fury uncle and former trainer, don warn say Anthony Joshua fit knock out Tyson when dem finally meet for ring. Peter talk dis for interview, say na only two things fit happen, either Tyson go outbox Joshua and beat am, or Joshua go find im target and hand Tyson di first knockout loss of im career. E say di outcome go depend on di game […]

todaySeptember 22, 2026 13

OBODO NAIJA

NSCDC Bust Illegal Juice Factory For Badagry, Gbab Two Women

Operatives of di Nigeria Security and Civil Defence Corps, NSCDC, don raid illegal juice factory for Aradagun area of Badagry, Lagos, and arrest two women. Di factory wey dem dey produce drink wey dem call Barkas Juice, dey Talabi Onilegbale Street, Aradagun, Olorunda LCDA, and NSCDC operatives discover am on September 19, 2026, around 9pm. Di two women, aged 48 and 50, bin dey di factory when NSCDC operatives from […]

todaySeptember 22, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds