News-edi 1

1355 Results / Page 7 of 151

Background

OBODO NAIJA

Police Carry Joshua Driver Go Court

By: Rilwan Agbomeji Ogun State Police don carry driver of Lexus SUV wey involve for crash with boxing champion Anthony Joshua go court. Dem arraign di driver, Adeniyi Mobolaji Kayode, 46 years old, for Sagamu Magistrate Court on Friday, January 2, 2026. Police talk say dem charge am because of di accident, and di case don officially enter court. According to police spokesman, Oluseyi Babaseyi, di man face four charges, […]

todayJanuary 2, 2026 15

Lagos

Sanwo-Olu Revisit GNI Building, Say 8 People Kpai

By: Rilwan Agbomeji Oga govo of Lagos state, Babajide Sanwo Olu don go back see di extent of damage for di Great Nigeria Insurance (GNI) building on Lagos Island for Balogun market wey burn last wee. Oga govo say so far na 8 pipo dem don confamate dead for di ugly marra. Visiting di site on Friday 2 January, 2026, di govo give a total breakdown of wetin relly hapun […]

todayJanuary 2, 2026 8 2

Sports

Mozambique Presido Promise To Give Players Bonus To Beat Super Eagles

By: Rilwan Agbomeji Mozambique Presido, Daniel Francisco Chapo don hail di Mambas afta dem qualify for di Round of 16 for 2025 Africa Cup of Nations wey dey happen for Morocco. E yarn tori pipo on Friday, say, di team show correct football and make di whole country proud, even though dem lose 2-1 to Cameroon for dia last group match. Chapo say di achievement na big one wey nobody […]

todayJanuary 2, 2026 8

Lagos

Sanwo-Olu Salute Lagos Pipo Grit, Promise To Run Matas Well For 2026

By: Rilwan Agbomeji Lagos State Governor Babajide Sanwo-Olu wan finish Lagosians with hailings say dem get strong mind, dat dem sabi somtin, and sabi cooperate. Di senior man of di state sukili dis one for im 2026 New Year message, e promise say im govment go focus more on people mata and hear wetin dem need. Sanwo-Olu yarn say everybody go need patience and join bodi, and im go dey […]

todayJanuary 2, 2026 9

obodo oyinbo

Yemen Wahala, Say Saudi-Pipo An Separatists Scarra Yemen Border With Fight

By: Rilwan Agbomeji Fighting don break for Yemen, for Hadramout province wey dey near Saudi Arabia, between forces wey follow Saudi-backed govo and di Southern Transitional Council (STC) separatists. STC talk say Saudi Arabia dey bomb dia pipo near di border, but oga govo,  Salem al-Khanbashi yarn say dem just wan take back military bases “peacefully and systematically.” STC tuk, tuk, Lieutenant-Colonel Mohamed al-Naqib yarn say dia dey fight serious […]

todayJanuary 2, 2026 7

Sports

Super Eagles Star Lookman Make CAF Best XI

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles forward Ademola Lookman sef make di best players list for group stage of 2025 AFCON, and na di only Nigerian wey dey di team. CAF pick lookman as one of three midfielders alongside Morocco own Brahim Diaz and Cameroon own Carlos Baleba. Lookman score two goals and give two assists for only two matches, including di match-winning goal against Tanzania. Meanwhile, Nigeria coach Eric Chelle […]

todayJanuary 2, 2026 21

OBODO NAIJA

Nasarawa Govment Beg Lecturers Make Dem Stop Strike

By: Rilwan Agbomeji Di Nasarawa State Govment don beg lecturers wey dey strike for state tertiary schools, say, make dem stop dia action so negotiation fit continue. Joint Unions of Nasarawa State Tertiary Institutions (JUNSTI) don enter strike since December 29, 2025 because govment never pay full new minimum wage. Senior Special Assistant to Govo Abdullahi Sule tuk say di strike fit affect students as schools suppose don resume. E […]

todayJanuary 2, 2026 8 15

Sports

Lawal Wire SMS To Coach Eric Chelle To Tidy Eagles Defence

By: Rilwan Agbomeji Former Naija Midfielder Garba Lawal don advise Super Eagles Coachie, Eric Chelle and im technical crew say make dem sort di defensive issue of di super eafles for round of 16 Nigeria go face Mozambique Mambas on Monday for Fez Stadium to fight for quarter-final spot. Di former midfielder yarn am for on siddon talk show as fans dey ready cheer Nigeria for AFCON. Lawal talk say […]

todayJanuary 2, 2026 8

OBODO NAIJA

Malami And Im Pikin Go Still Siddon For Kuje Prison Reach January 7

By: Rilwan Agbomeji Former AGF and Justice Minister, Abubakar Malami, and im pikin, Abubakar Abdulaziz Malami, go remain for Kuje Prison reach January 7. Justice Emeka Nwite give di order on Friday afta court hear argument for and against dia bail application. Federal Government dey try Malami, im pikin and one Ramadiya Property staff, Hajia Bashir Asabe, over alleged ₦9 billion money laundering case. Court go decide on dia bail […]

todayJanuary 2, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app