News-edi 1

2593 Results / Page 76 of 289

Background

Health

CENTRAL AFRICA ON FIRE: Di Full Gist On Di Latest 2026 Ebola Outbreak

They say "wetin dey sweet for mouth, na inside stomach e dey turn to bitter leaf." That na exactly di story for one small village for Northeast Congo, where simple celebration turn to cry-cry night. Pesin wey no do any evil, wey just chop life with family, start to complain of small headache for evening,  by midnight, sweat don cover am, and before day break, strange blood start to run […]

todayMay 25, 2026 26

Sport Yarns

Onyinyechi smash world record as Nigeria pack 49 medals for African powerlifting Open

By : Jolayemi Olajide Naija Para lifters set records, Onyinyechi Mark smash both world and African records for the African Open Para-Powerlifting Championships plus as Nigeria pack 49 medals join bodi. Na so Team Nigeria finish for second position with 32 gold, 12 silver, and 5 bronze medals, meanwhile Egypt take first place after dem pack 84 medals total. Onyinyechi show dem pepper for di women’s 67kg category to change […]

todayMay 25, 2026 29

OBODO NAIJA

Police begin touchlight how Popular Businessman “Egonaejeije” take kpai inside Abuja House!

By : Jolayemi Olajide Police for Abuja don begin dig inside mata of how pipo kpai one big electronics businessman, Chief Godwin Chinedu Lucky Adimike, wey many people know as “Egonaejeije Na Awka-Etiti.” The 53-year-old businessman, wey get big face for Alaba International Market for Lagos, kpai for Karu General Hospital after dem find am with heavy wound for im house for Hassan Adamu Street, Guzape district. Dis sad level […]

todayMay 25, 2026 28

Lagos

 Lagos Gornment Arrest Over 10,000 for Highway crossing

By : Jolayemi Olajide Baba Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, don reveal say Lagos State Government arrest over 10,000 pipo for inside Alausa because of environmental law breaking. Wahab tuk dis one during dia 2026 Ministerial Press Briefing, say dem gbab 5,715 pipo wey dey cross highway, 102 people for open defecation, and thousands more for street trading, cart-pushing, and waste table-shaking. Di gornment carry out dis […]

todayMay 25, 2026 20

Lagos

 Lagos Gornment tell everybody to be Calming Down, say tools don ready for Ebola

By : Jolayemi Olajide Seniorman Commissioner for body mata Lagos, Akin Abayomi, don drop advice lagosians, say make everybody look Ebola, eye ball to eye ball, say na smally e be dat mehn gallant dey wait am. Nor be amebo say Ebola dey scattar some African countries including Dr congo. Abayomi say dem receive order from above, from Governor Babajide Sanwo-Olu, so dem don set tools to rascal di wicked […]

todayMay 25, 2026 25

Sport Yarns

Rangers Flog Ikorodu City 2-1 to Carry NPFL Cup for 9th Time

By : Jolayemi Olajide Everywhere stew for Enugu State on Sunday as dem collobi di Nigeria Premier Football League (NPFL) trophy for the ninth time, beating  Ikorodu City 2-1 for inside Lagos , but bad market hit Remo Stars wey go relegation because dem fail to beat Bendel Insurance. The Flying Antelopes enter the pitch with heavy pressure because dem know say. na only win go give dem the cup. […]

todayMay 25, 2026 26

obodo oyinbo

Trump Insist Say Iran Deal Still Need More Time

By : Jolayemi Olajide US Presido, Donald Trump don drop micro soft word again oh,  say confusion sti gadima, dat  Iran nor gree peace deal oh. Na im  workers for White House naim dey porpori dis mata  on sunday,  say, as dem dey look am with corner eye, say di final agreement fit take some days before e go  set. According to wetin one Al Jazeera reporter for Washington, DC […]

todayMay 25, 2026 24

OBODO NAIJA

President Tinubu wipe Osifo, collobi APC Ticket for Second Term Race

By : Jolayemi Olajide Oya hear the big gist for Abuja, as Baba Presido, Bola Tinubu don grab di APC ticket again, to run for second term inside the next election. Tinubu win dis primary election with big score wey dey throw backy, dey look opponent dey laugh, say dem nor reach. Di senior man presido collobi  10.9 million votes to flog di only challenger, Stanley Osifo, wey only get […]

todayMay 25, 2026 16

OBODO NAIJA

Gunmen attack Kwara prayer house, kpai 3, carry 15 go

By : Jolayemi Olajide Nor be small tin oh, na so Some jaguda boys go kpokpo one  prayer house for Ori-Oke Ajaiye, near Ikiran village inside Ekiti Local Government Area of Kwara State, on Saturday night. According to report, di bad boys attack, di pipo when dem dey do night vigil,  dem kpai three worshippers and carry 15 other pipo go bush. The Kwara State Police Command, through dia tuk, […]

todayMay 25, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds