News-edi 1

2593 Results / Page 74 of 289

Background

Lagos

Lagos Police Gbag Iron Damage Man Say Im Fake Im Own Kidnap

Lagos State Police Command say dem gbab one scrap iron dealer, and im friends, say wey dem chout iron damage, iron damage na pipo dem dey kidnap, dey damage pipo peace. Lagos Police Commissioner,  Fatai Tijani,  naim dey break dis news on Tuesday give journalists for dia headquarters for Ikeja. According to di senior officer, di iron damage guy even fake im  own kidnap because he wan use format take […]

todayMay 27, 2026 16

Lagos

Lagos Gornment Recover ₦270m From 419 House Agents

Lagos State Gornment don announce say dem kpake over 270 million naira  from di hand of 419 estate agents and house developers to give di owners  wey dem cheat. Di Commissioner for Housing, Moruf Akinderu-Fatai, naim dey break dis news on Tuesday during di 2026 Ministerial Press Briefing wey happen for Alausa, Ikeja. In fact Akinderu-Fatai rake full newsppaer, say dis money wey dem recover, na just omomo doings and […]

todayMay 27, 2026 15

Lagos

Baba Sanwo-Olu Greet Muslims For Eid-el-Kabir

By : Jolayemi Olajide Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu, don congratulate all Muslims for Lagos and Nigeria as dem dey celebrate dis year Eid al-Adha Inside statement wey im Special Adviser on Media and Publicity, Gboyega Akosile, release on Tuesday, de govo tell pipo make dem hold di values of sacrifice, peace, and unity strong-strong. Sanwo-Olu say di festival dey remind everybody about how faith, patience, and to live with […]

todayMay 26, 2026 28 4

OBODO NAIJA

Lagos Police Burst Kidnap, Robbery Gangs, Kpai Four Suspects for Gun Battle

By : Jolayemi Olajide Lagos State Police don knack chest say dem block one major gbege for inside the state, as dem burst serious kidnap and robbery gangs, come kpai four suspects during heavy gun battle. The Senior Man for the Command, Commissioner of Police Tijani Fatai, naim yan this one give aproko people during dia monthly press briefing for the Force Headquarters. According to CP Fatai, the gallant operatives […]

todayMay 26, 2026 17

Sport Yarns

Manchester City Appoint Enzo Maresca As Dem New Coach To Replace Pep Guardiola

By : Jolayemi Olajide Manchester City don confirm say dem don appoint Enzo Maresca as dia new head coach, and di deal go run till June 2029. Maresca dey replace Pep Guardiola to start new levels for Etihad Stadium after the two sides agree on everything. The 45-year-old Italian coach go take over first-team work immediately and im go also join hand arrange the players wey the club go buy […]

todayMay 26, 2026 24

OBODO NAIJA

Court throwey case to block Goodluck Jonathan from 2027 election

By : Jolayemi Olajide Federal High Court for Abuja don throwey di case wey some pipo file to stop former Presido Goodluck Jonathan not to enter the 2027 presidential election. The court say di case na total waste of time and mouth-wash.Because of this one, the judge order the person wey carry the case come make he pay Jonathan N21 million for all di stress. As if dat one no […]

todayMay 26, 2026 27

OBODO NAIJA

 Police and local hunters kpai three kidnappers, rescue victim for Oyo State

By : Jolayemi Olajide Oyo State Police Command don tuk say dem Rambo style kpai three suspected kidnappers and rescue one person wey dem bin kramp for Otu area inside Oke-Ogun axis. Di police tuk, tuk, DSP Ayanlade Olayinka, clear dis one for statement wey im release on Tuesday. Dem talk say the heavy operation hapun after local hunters call dem for help on Monday, May 25, 2026, when the […]

todayMay 26, 2026 22

obodo oyinbo

Naija and Türkiye Sign Big Deal to Take Mining to Next Level

By : Jolayemi Olajide Naija and Türkiye don sign fresh agreement for Istanbul to join hand work for solid minerals and mining mata. Nigeria Minister of Solid Minerals Development, Dele Alake, naim use im yamchop mouth break di news say Baba Tinubu support di movement. Alake say di country don ready to work with the Turkish gornment to change how they dey manage mining, train pipo, and bring beta development. […]

todayMay 26, 2026 20

OBODO NAIJA

Tinubu salute Muslims for Eid, say goment dey work round di clock to fix Naija

  By : Jolayemi Olajide Wi oga Presido, Bola Tinubu don assure Nigerians say all the reforms wey im goment dey do go continue and dat im dey mout mehn to handle security, steady economy, and progress. Inside im 2026 Eid-el-Kabir message wey comout on Tuesday before Wednesday celebration, baba Seyi salutate all Muslims for Nigeria and across di world. Tinubu talk say true-true, im know say some areas still […]

todayMay 26, 2026 27

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds