News-edi 1

1754 Results / Page 75 of 195

Background

National

Tinubu 65 Ambassadorial Nominees Brace For Senate Grilling

By: Rilwan Agbomeji Next week, wi Presido Bola Ahmed Tinubu 65 ambassadorial nominees go siddon for front of lawmakers for grilling, to know whether dem dey qualify or not. Three opposition senators wey yarn under cover don drop warning say dis screening no be cruise, na only people wey get brain, backbone and clean name go escape, because foreign mission work no be job for smallie dem. For Thursday main […]

todayDecember 5, 2025 26

Sports

Troost-Ekong – Wetin Make Me Retire From Super Eagles

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles Captain, William Troost-Ekong don explain why e retire ahead of 2025 AFCON. Di 32-year-old defender wey don dey carry Naija flag for almost ten years don officially waka comot on Thursday, draw curtain on im international wahala. Even though Éric Chelle put im name for di provisional AFCON list, Ekong talk say e no go follow because na now im feel say time don reach […]

todayDecember 5, 2025 15

National

Obi Blast Campaign – Cars Dey Scatter, Priorities Dey Lost

By: Rilwan Agbomeji Labour Party 2023 Presidential Candidate, Peter Obi don drop mata for ground say di way all dis big politicians take dey spend money on top big big motor, na concern. Obi talk say for time wey Naija pipo neva chop, no gey job , dey fear kidnaping, ni senior political big names  dey spend public money buy big big motor for political campaign, say e no good […]

todayDecember 5, 2025 10

Lagos

Court Nab Man Wey Try Export Cocaine, Igbo From Lagos

By: Rilwan Agbomeji Federal High Court for Lagos don order make dem dump one man, Uche Ezeh for Ikoyi Correctional Centre afta e confess say e try export 4.40kg cocaine and 11.50kg cannabis. Judge talk say e go siddon till December 12, 2025, until dem open di full gist, check all di facts, and drop final judgment for im head. NDLEA drag am for four-count charge, FHC/L/30/2025, and arraign am […]

todayDecember 4, 2025 15

Lagos

One Person Kpai As Jaguda Boiz Scatter Ground For Lagos

By: Rilwan Agbomeji At least one person don kpai afta heavy fight burst between suspected Aiye and Eiye cult members for Awoyaya, Ibeju-Lekki, Lagos. Di fight burst from Monday enter Tuesday, and before people know wetin dey sup, one guy wey dem sabi as Pelebe don kpai inside di cult gbege. Videos just dey show show bodi online how di wahala, take scatter pipo for Awoyaya . Di video show […]

todayDecember 4, 2025 8

Lagos

Temu Join Body With Dellyman To Run Deliveries Sharp-Sharp Across Naija

By: Rilwan Agbomeji Temu, di fast-growing global e-commerce giant, don link up with Lagos-based startup Dellyman to run deliveries across Naija, dey ready shake di whole market wella. Dis move follow afta Dellyman pilot run wey dem deliver over 1,300 packages with 95% success, show say dem fit handle heavy e-commerce gbege for anywhere for Obodo Naija. Since 2020, Dellyman don turn one of Naija most reliable same-day and last-mile […]

todayDecember 4, 2025 8

Sports

Why We Scatter Chelsea 3-1 – Leeds Oga Daniel Farke

By: Rilwan Agbomeji Leeds United oga, Daniel Farke yarn say dem jam Chelsea 3-1 Wednesday night because im players really carry fire put show, run dem blues all over for dia house, no gree give dem chance to breathe. Farke dey shine eye as Ao Tanaka, Jaka Bijol, and Dominic Calvert-Lewin burst goals wey scatter Chelsea defense, carry Leeds run riot for Elland Road. We dey mad hungry to carry […]

todayDecember 4, 2025 13

National

Suspects Don Yarn Reason Why They Kpai Ogun FRSC Officer And Her Pikin

By: Rilwan Agbomeji Osun State police command don kramp one jaguda boi, victor fajemirokun wey kpai im girl friend, wey be Federal Road Safety Corps officer, Lasisi Funmilayo and her pikin, Sewa Lasisi. According to reports, di police parade di forty years old business man alongside two babalawo wey dia name be, Gboyega Daramola and Sunday James, for Osun State Police HQ, Osogbo on Wednesday. Oga Victor open im mouth […]

todayDecember 4, 2025 8

National

Senate Wan Tag Kidnaping As Terror Work

By: Rilwan Agbomeji For Wednesday for Abuja, We Senate don run mata again katapot change for di 2022 Terrorism Act  say, moving forward, any jaguda  wey do kinaping, whether na money take support oh, or na u spiderman wey  give informate, or ur work na to hide victim, any how any how so far u dey involve say na death penarity now ooo. Di bill show bodi for di house […]

todayDecember 4, 2025 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app