News-edi 2

1844 Results / Page 118 of 205

Background

OBODO NAIJA

Wike Shenk Makinde Presidential Ambition, Say no Joinbody Between PDP And APM  

By : Jolayemi Olajide Minister of FCT, Nyesom Wike once again don distance di pipo democratic party, PDP with any form of ejima doings with  Allied Peoples Movement, APM. You sabi say, Oyo state govo, Makinde  go  declare im interest for presidency, for rally wey hapun for Ibadan, say dem wan join force with APM. In reaction, di Moral govo,  tortorri dis mata as im go inspect ongoing road projects, […]

todayMay 15, 2026 14

OBODO NAIJA

President Tinubu Open Naija for Ground Say Make Investor Come Invest

By: Jolayemi Olajide Wi oga Presido,  Bola Tinubu (don open naija economy for ground waaa) don clear mata oh, say like dis now,  Nigeria fit attract nearly $20 billion foreign direct investment for 2026, based on say na sabi pipo dey run matas for di gorment. Tinubu yarn dis one on Thursday during Africa CEO Forum wey shelle for Kigali. Baba Seyi  also explain say gornment don put beta benefits […]

todayMay 15, 2026 19

Lagos

Sanwo-Olu Hail Olanrewaju for Betterment for  Banking Leadership

By : Jolayemi Olajide Senior man govo, Babajide Sanwo-Olu don (don pelle beta salutate give ) Prof. Pius Olanrewaju, say dis particular senior man try for Naija Chartered Institute Bankers. Di governor, through Lagos Commissioner for Finance, Abayomi Oluyomi, tuk dis one on Thursday, during Olanrewaju sent fort party for Bankers House, Victoria Island, Lagos. According Baba Sanwo Olu, Olanrenwaju suppose enter  di AMA, make Igwe give am award, say […]

todayMay 15, 2026 11

Sport Yarns

Jake Paul Make Plans To Retire Afta Joshua Scatter Im Jaw

By: Esther Ayoola Say like dis now, Jake Paul dey plan retirement from combat sports afta di YouTuber beating from Anthony Joshua. Say di 500 wey touch back in dat December fight sti dey make im head dey shake. For dia last fight last December, Joshua knock am out brutally. Di fight leave Paul with broken jaw wey force am undergo corrective surgery. Since den, di American boxer never return […]

todayMay 13, 2026 21

Lagos

Why NBA, Rights Committee Dey Push For Police Partnership For Lagos

By: Esther Ayoola Chairmo of Naija Bar Association, Lagos Branch, Uchenna Akingbade, joinbodi with Human Rights Committee Chairmo, James Sonde, don call for beta working relationship between lawyers and police to improve justice system. Dem tuk dis one during courtesy visit to AIG FCID Annex, Alagbon Close, Ikoyi, Lagos, on Tuesday. According to statement from FCID spokesperson, ASP Aminat Mayegun, di visit na to strengthen cooperation between lawyers and police […]

todayMay 13, 2026 18

Sport Yarns

Jason Collins, First Gay NBA Player, Die at 47

By: Esther Ayoola Former NBA player Jason Collins don kpai for age 47 afta im battle with brain cancer, im family announce am. According to report, say e kpai afta wetin dem describe as “valiant fight” against glioblastoma, serious brain cancer wey no get cure. According to NBA announcement wey BBC report on Wednesday, Collins first reveal for 2025 say him get di sickness afta him begin get problem with […]

todayMay 13, 2026 11

obodo oyinbo

China, US Trade Tuks Start For South Korea

By: Esther Ayoola Delegation from China and United States don meet for trade tuks for South Korea on Wednesday. According to Chinese state media Xinhua di meeting hapun for Incheon International Airport near Seoul as US Treasury Secretary Scott Bessent and Chinese Vice Premier He Lifeng lead di negotiation. Dem tuk say di reason for di tuks na to continue ongoing trade discussion between both countries as US President Donald […]

todayMay 13, 2026 11

Lagos

Governo Sanwo-Olu Hail LASU Say Dem Get Di Highest Registration For JAMB

By: Esther Ayoola Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu don hail Lagos State University as di university with most application for Naija afta di school receive 84,426 applications for 2026 UTME. According to Joint Admissions and Matriculation Board figures, University of Lagos come second with 78,240 applicants, while Obafemi Awolowo University get 60,370 applications. University of Ibadan and University of Benin compete top five with 58,895 and 55,425 applicants respectively. Reacting […]

todayMay 13, 2026 25

Lagos

Obasa Enter Race For Agege Reps Seat As APC Primaries Near

By: Esther Ayoola Speaker of Lagos State House of Assembly, Mudashiru Obasa don declare say e wan contest for Agege Federal Constituency seat for House of Reps. Obasa tuk dis one on Tuesday for Agege during stakeholders meeting wey hapun ahead of APC primaries for Lagos. Di sixth-term lawmaker press tuks say na party leaders for di constituency naim dey encourage am to enter di race for federal level. Dat […]

todayMay 13, 2026 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds