News-edi 2

1378 Results / Page 50 of 154

Background

south west

Governor Makinde Beg Government As NLC, NUT, And NANS Protest Over Oyo School Kidnap

By: Esther Ayoola Oyo State govo, Seyi Makinde, don call on all levels of gornment make dem join hand together fight security wahala and rescue di students and teachers wey bad boys kidnap for Yawota and Ahoro Esinele communities inside Oriire Local Government. Governor Makinde tuk dis one on Tuesday when im receive leaders and members of NLC, NUT, and NANS wey do peaceful protest for di state  Secretariat. Di […]

todayJune 3, 2026 10

south west

Senate Cry Out Based On Bad Boys Doings For Oyo

By: Esther Ayoola Di Senate on Tuesday don condemn di way bad boys take pakalam (kidnap) school children and dem teachers for Oyo State. Di Senate President, Godswill Akpabio, tuk say dis bad tin wey hapun na national tragedy and na attack on top everybody humanity. Akpabio cry say as di country no fit protect children and teachers, dis insecurity tin fit spoil Naija future and di education system kpata-kpata.

todayJune 3, 2026 9 5

Lagos

Police Catch Accountant Wey Run Go Canada Afta Im Thief Theif ₦150m For Lagos

By: Esther Ayoola Zone 2 Police Command for Onikan, Lagos don gbab one accountant wey dem dey accusate, say im gada mehn go rob one house for Maryland, carry property of about ₦150 million loss. According to Oga Assistant Inspector-General of Police (AIG) for di zone, Olohundare Jimoh, say na since July 2025, dem don dey find dis person But dem trace am, con catch am for one corner as […]

todayJune 3, 2026 10

Sport Yarns

Chelsea Enter Osimhen Mata As Galatasaray Put €150m Price Tag

By: Esther Ayoola Chelsea don join race to sign Super Eagles striker Victor Osimhen, as reports from Turkey say Galatasaray dey demand €150m for di Nigerian star. Speculation about Osimhen future rise afta Super Eagles coach Eric Chelle tuk say na transfer mata make di striker miss Naija friendly matches against Poland and Portugal. But Osimhen don clear di air, saying people misunderstand Chelle comment, as he insist say no […]

todayJune 2, 2026 14

National

How Unknown Gunmen Kpai 4 pipo Attacking Soludo Chief Of Staff Convoy

By: Esther Ayoola Nor be small mata for Anambra state as some jaguda boys go attack convoy of Governor Chukwuma Soludo Chief of Staff, Chief Ben Nwankwo, for Amansea–Ndiora–Ndiukwuenu–Awa–Ufuma Road in Orumba North Local Government Area of Anambra State on Sunday night, kpai 4 pipo. Investigation show say two police officers and two civilians wey dey inside di convoy naim kpai as di jaguda boys blast balst di motor. On […]

todayJune 2, 2026 15 3

obodo oyinbo

Ireland Clear International Students To Get Long-Term Visa First

By: Esther Ayoola Ireland Immigration Service Delivery don announce say all international students wey no be citizens of European Economic Area and wan study for Ireland pass three months gat get long-term study visa before dem travel enter di country. According to report wey Economic Times carry on Tuesday, di immigration authority tuk say applicants must apply from dia home country or any country wey dem dey legally reside before […]

todayJune 2, 2026 15

National

Gunmen Kpai Five As Dem Open Fire For Plateau Village Party

By: Esther Ayoola Five pipo naim kpai afta gunmen open fire for Gwan-Ajang village for Foron District, Barkin Ladi LGA of Plateau State on Sunday night. According to police tuk, tuk person, Alfred Alabo, di attack happen while villagers gather for one event. Di seniorman police explain how dem take quickly send officers from Gindiri Division go di area and dat now dem dey do investigation.

todayJune 2, 2026 17

National

Former SGF, Lawal Pack Load Comot ADC, Say Wuruwuru Dey Di ADC Primary Election

By: Esther Ayoola Former Secretary to di Gornment of DI Federation, Babachir Lawal, don pack im load comot from DI African Democratic Congress (ADC) party. Lawal use his Facebook page on Monday take announce am on Monday say na Aringas naim package di election for di party presidential primary to favour former Vice President Atiku Abubakar. Im scata mouth say di election na pure "wash" because dem change di real […]

todayJune 2, 2026 13

National

Wike Knock Peter Obi, Call Am Jell Off Rice Leader

By: Esther Ayoola FCT Minister Nyesom Wike don criticize former Anambra Govo and former Labour Party presidential candidate, Peter Obi, say leadership need courage and quick decision-making, nor be to dey run from problem, be di way. Wike tuk dis one, while im dey react to how pipo dey see Obi leadership style for TV sit down tuk. According to di senior man minister, say Obi na food is ready […]

todayJune 2, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds