News-edi 2

1832 Results / Page 53 of 204

Background

Uncategorized

Osun Gornment Drag EFCC Go Court Over Frozen Bank Accounts

By: Esther Daniel Osun State Gornment don drag EFCC go Federal High Court after di anti-graft agency freeze gornment bank accounts, as Gofnor Ademola Adeleke order legal action on Wednesday to challenge di move. Osun Attorney General and Commissioner for Justice, Oluwole Jimi-Bada, tok say EFCC issue "Post No Debit" directive to First Bank, where several gornment accounts dey, without getting court order first. Jimi-Bada explain say although EFCC fit […]

todayAugust 5, 2026 7

OBODO NAIJA

Osun Gornment Pay Fresh Palliative Give Civil Servants

By: Esther Daniel Osun State Gornment don pay anoda round of palliative give civil servants across di state to help reduce di effect of di hard economy. Gofnor Ademola Adeleke spokesperson, Olawale Rasheed, tok for Wednesday say di payment show say di gornment remain committed to workers' welfare. Im add say di administration start regular palliative payments before implementing di new minimum wage for Osun State. Di gornment say di […]

todayAugust 5, 2026 10

Health

Federal Gorment Go Build Autism Centres Across Nigeria

By: Esther Daniel Di Federal Gorment announce plan to establish autism centres across di six geopolitical zones of Nigeria to improve care for children wit developmental conditions and reduce medical trips abroad. Di Minister of Education, Dr Maruf Tunji Alausa, make di announcement during one stakeholders' engagement, im say gorment go also expand specialist training for Audiology, Speech and Language Therapy, and Occupational Therapy. Alausa explain say di initiative go […]

todayAugust 5, 2026 17

Politics

EFCC Reportedly Freeze Osun Gorment Salary Account Before Gofnorship Election

By: Esther Daniel EFCC reportedly freeze one Osun State Gornment account for First Bank wey dem say gorment dey use pay workers, just days before di August 15 governorship election. Gofrnor Ademola Adeleke say di action no get legal backing and accuse EFCC of targeting di state before di poll. Di Osun State Gornment describe di report move as attempt to disrupt gorment activities. One source close to di administration […]

todayAugust 5, 2026 18

National

PFN Say Dem No Go Stop To Preach For Bus

By: Esther Daniel Di Presido of Pentecostal Fellowship of Nigeria, Bishop Wale Oke, tok on Wednesday for sidun talk say Christians go continue to preach for commercial buses even if authorities arrest dem. Im react to di FRSC Amendment Bill 2026 wey propose ₦50,000 fine for anybody wey preach inside commercial vehicles. Oke say any law wey stop public preaching go violate dia constitutional right to spread di gospel. Im […]

todayAugust 5, 2026 13

Politics

Donald Duke Blast Lagos Calabar Highway, Say Na Wrong Priority

By: Esther Daniel 2027 presidential candidate for Peoples Redemption Party, Donald Duke, tok on Tuesday during interview for sidun tuk say Lagos-Calabar Coastal Highway na wrong priority because Nigeria no fit afford di project. Di former Cross River gofnor argue say road already dey from Lagos to Calabar, so gornment suppose repair am instead of spending billions on new highway wey im believe e no go pass Epe. Duke say […]

todayAugust 5, 2026 13

Sports

Real Madrid Loan Franco Mastantuono to Fiorentina

By: Esther Daniel Real Madrid on Wednesday agree to send young Argentine midfielder Franco Mastantuono on one-season loan to Fiorentina, as di player go return to Spain by June 2027 to continue im career. Transfer expert Fabrizio Romano confirm di agreement, say both clubs don settle di deal for Wednesday morning. Di loan move make Mastantuono di third Real Madrid player wey don leave di club this week. Earlier, Cesar […]

todayAugust 5, 2026 16

OBODO NAIJA

Sam Amadi Knock APC Over Alleged Fake Catholic Statement

By: Esther Daniel Former NERC Chairman, Sam Amadi, on Wednesday call on APC through im X page make di party stop alleged forgery, say dem fit defend dia position without using fake documents. Amadi react after Catholic Youth Organisation of Nigeria (CYON) deny one statement wey circulate online, claim say e come from one group called Catholic Youth Association of Nigeria (CYAN). CYON describe di document as false, fraudulent and […]

todayAugust 5, 2026 9

Sports

Super Falcons Fit Top Group C If Dem Beat Egypt

By: Esther Daniel Super Falcons go battle Egypt on Wednesday night for Rabat as dem chase victory and chance to finish top of Group C for 2026 Women Africa Cup of Nations. Nigeria need beat Egypt while Zambia defeat Malawi for all three teams to end di group stage with six points each. If dat happen, CAF tie-break rules go decide who go finish first and second for di group. […]

todayAugust 5, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds