News-edi 2

1834 Results / Page 64 of 204

Background

obodo oyinbo

US, Iran Still Dey Exchange Words As Tension Rise

By: Yusuf Abuh Tension between America and Iran still dey high as US Presido Donald Trump konfam say Washington and Tehran dey hold "friendly tuks," but e no believe say long negotiations go help. Dis one dey inside statement, Iran come reply say na America dey struggle to find beta way to end di conflict between both countries. Meanwhile, Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu don land Washington, DC, to meet […]

todayJuly 28, 2026 24

OBODO NAIJA

FG Send South Africa Message To Stop Attacking On Nigerians Now

By: Yusuf Abuh Wi Federal Government don warn South Africa make dem take serious action to stop di fresh wave of xenophobic attacks wey dey target Nigerians and oda Africans for dia country. Minister of State for Foreign Affairs, Ambassador Sola Enikanolaiye, yarn dis one during meeting with South Africa Minister of International Relations and Cooperation, Ronald Lamola, say na about 98 Nigerians don kpai  since 2022, and criminals suppose […]

todayJuly 28, 2026 20

Lagos

Lagos Taskforce Gbab 33 Suspects, Recover Drugs And Dangerous Weapons

By: Yusuf Abuh Lagos State Environmental and Special Offences (Enforcement) Unit don go kramp 33 suspected jaguda criminals on Monday for different areas of Lagos Island and Lekki corridor. Di Agency tuk tuk person, Raheem Gbedeyan, naim sorosoke dis mata, say di pipo wey dem gbab include area boys, pipo wey dey sell  drugs, drug addicts, illegal okada riders, ticket touts and other jadugas, while officers recover Tramadol, Indian hemp, […]

todayJuly 28, 2026 22

Sports

Super Falcons Pepper Morocco, Rock Correct Adire Before WAFCON Showdown

By: Yusuf Abuh Defending champions Super Falcons don land Rabat, Morocco, on Saturday wearing correct green-and-white Adire with matching head ties as dem ready for dia first match and chase record 11th Women's Africa Cup of Nations title. Di players no just stop for football, dem also use dia fine traditional outfits make social media videos and snap pictures to proudly show Nigerian culture. Esther Okoronkwo, Jennifer Echegini and Michelle […]

todayJuly 27, 2026 20

obodo oyinbo

Oil Price Drop As US And Iran Ceasefire Raise Hope For Peace

By: Esther Daniel Oil prices don fall on Monday after fresh hope emerge say ceasefire between United States and Iran fit hold, as both countries show signs say dem fit return to peace talks. Di United States no launch any fresh attack over di weekend, while one top US official tok say Presido Donald Trump dey give negotiations chance to continue. Iran also announce say e go stop retaliatory attacks […]

todayJuly 27, 2026 25 5

National

Peter Obi Question Borrowing, Say Nigerians Never See Improvement

By: Esther Daniel 2027 presidential candidate of di Nigeria Democratic Congress (NDC), Peter Obi, don question di current administration over increased borrowing despite saying subsidy payment don stop. Obi tok say even though Gornment dey generate more revenue from different sources and no longer dey pay fuel subsidy, di country don still borrow pass when subsidy dey. According to am, ordinary Nigerians never see any visible improvement for dia daily […]

todayJuly 27, 2026 16 2

National

Peter Obi Repeat Promise, Say Four Years Is Enough To Fix Nigeria

By: Esther Daniel 2027 presidential candidate of di Nigeria Democratic Congress (NDC), Peter Obi, don repeat say if Nigerians elect am as Presido, e go serve only one term because four years dey enough to put Nigeria for di right path. Obi tok during one siddon tuk interview say im one-term promise no be campaign strategy, adding say e and im running mate, Rabiu Kwankwaso, agree on di arrangement based […]

todayJuly 27, 2026 21 2

Lagos

Deputy Govo Hamzat Deny One-Term Agreement, Promise To Build Lagos

By: Esther Daniel Lagos State Deputy Govo and APC gofnorship candidate for di 2027 election, Dr Obafemi Hamzat, don deny reports say e get agreement to serve only one term if e become governor. Hamzat, fry mouth inside one interview, wia dem fire fire am beta question untop di matas say im wan run one term. Baba Hamzat raise hand up say im nor get hair for ampit, dat im […]

todayJuly 27, 2026 14 2

OBODO NAIJA

MURIC Tell Adeleke Make E Begin Pack Comot Gornment House

By: Esther Daniel Muslim Rights Concern (MURIC) don tell Osun State Govo, Ademola Adeleke, make e begin prepare to leave Gornment House, say plenty people for di state don reject im administration. For statement wey Executive Director of MURIC, Professor Isiaq Akintola, sign on Monday, di group accuse Adeleke say e deceive Osun people with promises wey no match wetin dey happen for ground. Akintola also claim say one flyover […]

todayJuly 27, 2026 15 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds