News-edi 2

1959 Results / Page 5 of 218

Background

obodo oyinbo

Trump Tuk Say Iran War Go End Soon

By: Kofoworola Olayinka US Presido Donald Trump don tuk say di war between US and Iran fit end soon. E tuk dis one for a campaign rally for San Antonio, Texas on Wednesday. Trump say Steve Witkoff, wey be US tok tok pesin wen dey follow iran pipo dem tok, dey work on how dem fit stop di war. E say Witkoff dey do well for di tuk Trump also […]

todayOctober 8, 2026 10

National

Uzodimma Praise Security pipu As 20 Corps Members don Free

By: Kofoworola Olayinka Imo State Gofnor, Senator Hope Uzodimma, don clap hand for security pipu as dem sharparly  rescue di 20 corpers wey kidnappers carry for Onitsha-Owerri Road. Di gofnor say e happy say police, army and oda security pipu join hand make dem rescue di corps members safely. E praise dem for dia hard work and love for di country. Uzodimma also praise Oyo and Imo State Gornment for […]

todayOctober 8, 2026 15

obodo oyinbo

Japan Helep Yemen And Djibouti with $10m Emergency Funds

By: Mariam Ajayi Japan don become snior helpers fo middle east, dem don approve $10 million emergency aid for Yemen and Djibouti based on di war wey don scarra dis two both countries. According by di  Japanese embassy, Japan gornment approve di money on Tuesday. Yemen go get $8 million from World Food Programme, International Committee of di Red Cross and International Organization for Migration, while Djibouti go get $2 […]

todayOctober 7, 2026 18

OBODO NAIJA

Umahi Comot Some Barriers For First Niger Bridge

By: Mariam Ajayi Works Minister, Dave Umahi, start to dey comot some concrete barriers wey dem put for First Niger Bridge to divide di narrow road into two lanes. Di barriers cause plenty kasala last week as road users and engineers say dem fit make traffic worse and make emergency movement hard for di bridge. Di Works Ministry bin say di barriers na to control traffic and stop reckless overtaking […]

todayOctober 7, 2026 14

OBODO NAIJA

Donald Duke Say INEC Gats Assure Free And Fair 2027 Election

By: Mariam Ajayi Senior man, People Redemption Party, presidential candidate, Donald Duke, say fear dey di land for dis 2027 election mata, INEC gats convince Nigerians say di 2027 election go free and fair. Duke fire dis mata for news tok norbi small, say di way dem take run di 2023 presidential election don open Nigerians eyes waah for ground. Wey dem fire am question wetin change, di former Cross […]

todayOctober 7, 2026 11

Lagos

Passenger Kpai Inside Kenya Airways Plane Wey Dey Come Lagos

By: Mariam Ajayi One Kenya Airways plane wey bin dey come Lagos from Nairobi, say from no wia, person just kpeme for plane as hin near Lagos. Nobody sabi wetin kill di man. According by infomate wey di airline tok tok person, Michael Achimugu, bring out, di passenger just stop to respond about 20 minutes before di plane land and dem try first aid, kpokrikpor, di man don go, otilor. […]

todayOctober 7, 2026 11

Sports

Messi End Argentina Career With Goal And Two Assists

By: Mariam Ajayi Lionel Messi don end im Argentina international career with one goal and two assists as Argentina beat Benin 3-0 for Buenos Aires on Tuesday night. Messi set up Nicolás Otamendi for Argentina first goal for 48th minute before e assist Nico Paz for di second goal for 61st minute. E later score penalty for 71st minute to complete Argentina 3-0 win over Benin. Di match na Messi […]

todayOctober 7, 2026 16

obodo oyinbo

Sudan Army Chief Swear To Fight RSF To Take Back Sudan Land

By: Mariam Ajayi Sudan army chief, Abdel Fattah al-Burhan, don swear say hin no go gree, da thin nor dey tok with RSF,  di ogbonge paramilitary group wey dey disturb sudan, say na force hin go take comot dem from sudan. Al-Burhan drop dis yans on Tuesday for Merowe, say, since di RSF pipo nor wan hear word,  na pure war, Idaboski doings,  be di only option to finish  paramilitary […]

todayOctober 7, 2026 11

OBODO NAIJA

Obi Tuk Again Say E Go Bring Back Fuel Subsidy If E Win

By: Mariam Ajayi Senior man presidential of di Nigerian Democratic Congress, Peter Obi again don fire mouth  say e go bring back fuel subsidy if e win di 2027 presidential election. Obi porporly dis mata dis one on Tuesday during interview with BBC. According by weitn di b4 anambra state govo tok say di main problem with fuel subsidy na  di corruption inside and dat once hin enter office im […]

todayOctober 7, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds