News-edi 2

1834 Results / Page 95 of 204

Background

International

Di first batch of Nigerians from South Africa don land on Thursday

By: Shalom Ovie Di first batch of Nigerians wey leave South Africa because of anti-foreigner attacks dey expected to arrive Lagos on Thursday. Officials say di return follow weeks of violence against immigrants for the country. Armed groups don threaten make pipo wey no get residency papers leave before June 30. Di attacks don cause fresh fear among foreigners for South Africa.  

todayJune 11, 2026 14

Lagos

APC Aspirants clear Obasa name say Nor be im Sponsor Lagos Protest

By: Shalom Ovie Some All Progessives Congress aspirants for Lagos don explain how Speaker Mudashiru Obasa hand nor dey inside di protest over di party primaries. According to di protesters, say na based on say many election ground nor package di wey e suppose be naim make, di election scatta Di group also reject claim say Obasa give N2 billion to support di demonstration. Dem insist say angry party members […]

todayJune 11, 2026 18

Politics

EFCC Oga explain how Politicians take dey Chop Gorment money

By : Shalom Ovie EFCC Chairmo, Ola Olukoyede, don open secrete tuk why public money dey lost, say na based on di fact politicians dey spend too much for election. Naim make once dem enter office, dem go begin gather money wey dem spend for election and con take extra. E tuk dis one on Wednesday for one lecture for University of Ilorin about peaceful and credible 2027 elections. However […]

todayJune 11, 2026 15

Sports

Omar Artan Return Mogadishu For Hero Welcome

Somali referee, Omar Artan, wey United States deny entry for World Cup duty, don come back Mogadishu for hero welcome on Wednesday as supporters gader for airport wave flag greet am. Artan tuk say e no go give up, promise say e go still participate for 2030 World Cup despite di rejection. di referee land for Mogadishu main airport through Turkish Airlines flight, where more dan 100 fans celebrate am […]

todayJune 10, 2026 19

foreign

Gunmen Kpai 12 For South Africa

Nor be small jogolo for South Africa, say 12 pipo don kpai after gunmen attack one small community, midnight on Tuesday. Police say about 10 attackers naim run dis package, enter different sides and begin shoot residents ratata for different locations. Police tuk tuk woman, Colonel Dimakatso Nevhuhulwi, say di suspects escape, while investigators begin touch light wetin really play for di area

todayJune 10, 2026 14

OBODO NAIJA

Obi Lawyers Drag Kenneth Okonkwo, Demand N5bn

Nor be small thin oh, as two best frens don turn enemies, say like dis, di Presidential candidate of Nigeria Democratic Congress, NDC, Peter Obi, don tell im lawyers say make dem drag former actor- wey turn-politician Kenneth Okonkwo to pay N5 billion damage dat im spoil im name for public According to tatafo, Kenneth go tv sit down tuk use yamchop call di former Anambra state govo bad name, […]

todayJune 10, 2026 17

Local

Osun Police Gbab Three Suspected Cultists

Osun State Police Command say dem don arrest three suspected cultists and political thugs during separate operations for di state. For statement wey Police Public Relations Officer, DSP Abiodun Ojelabi release on behalf of CP Ibrahim Gotan, dem identify di suspects as Adekola Olayinka Abdulazeez, Omolara Ezekiel and Babatunde Azeez. Police say dem recover dangerous weapons from dem including three English Beretta pistols, cut-to-size gun, live ammunition, cartridges, cutlasses and […]

todayJune 10, 2026 21

Lagos

Obasa Watch Hand Comot For APC Protest

Speaker of di Lagos State House of Assembly, Mudashiru Obasa, don warn, say make nobody use im name take organise protest or rally for di APC House of Assembly primaries. Obasa tok dis one as reaction to di protests wey hapun for different parts of Lagos and for di APC Secretariat for ACME Road, Ikeja, on Tuesday. E say some pipo dey try link and blame am for di demonstrations […]

todayJune 10, 2026 18

Sports

Atletico Madrid Reject Real Madrid €150m Bid For Julián Álvarez Deal

By: Esther Ayoola Real Madrid don reportedly offer €150 million to sign Argentine striker Julián Álvarez from city rivals Atlético Madrid. Dis na according to statement wey appear for dia website. Di club say di proposal come afta board meeting wey dem hold as dem dey look for top striker to strengthen dia attack. But Atlético Madrid quickly reject di offer, say Álvarez dey very important for dia project and […]

todayJune 10, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds