Blog horizontal

Background

National

Former Senate Presido Saraki Insist Say PDP Sti Get Life

By: Esther Ayoola Former Senate Presido, Bukola Saraki, say like dis now, di Pipos Democratic Party (PDP) sti  dey pull crowd wetin nor good and dat di parti nor scata anything. E yarn dis one for TV sit down tuk, say di parti sti get beta grassroot connect. According to am, say na quarrel dey cause di wrong impression, as plenty Nigerians sti dey support di party.

todayMarch 27, 2026 17

National

ASUU Give FG 4 Days To Start Paying Dia Agreed New Salary

By: Esther Ayoola Di Academic Staff Union of Universities, ASUU, don give Federal Gorment four days ultimatum to start to dey pay university lecturers with di new salary structure wey dem agree. ASUU Presido, Professor Christopher Piwuna, tuk dis one for one public lecture wey happen for Bauchi State. U sabi say Dem don agree on di new salary since December 2025, and e suppose start from January 2026. Piwuna […]

todayMarch 27, 2026 11

National

Vice Presido Explain How FG See Energy Security

Vice Presido Kashim Shettima don sti tuk say wi Federal Gorment nor go play wit energy security, because future of di country depend on am. Him yan dis one for di opening of Naija Electricity Liability Management Company (NELMCO) headquarters for Abuja. Shettima say, NELMCO na promise to handle every every as e take concern energy security. E press tuk, say dis administration sabi say energy security na di koko […]

todayMarch 27, 2026 13

National

Vice Presido Shettima promise To Protect Nigerians Right

By: Esther Ayoola Vice Presido Kashim Shettima don go drop promise for international lawyers front, say Naija ready to protect human rights as e take dey inside constitution. Di Naija vice presido do dis one for Abuja on Thursday, when e dey open 2026 High-Level International Humanitarian Law Dialogue. Shettima say Naija ready every every, to collabo with other countries and follow International Humanitarian Law (IHL) for every conflict and […]

todayMarch 27, 2026 17

National

Saint Kitts PM Drew Meet Tinubu For Abuja

By: Esther Ayoola Prime Minister of one ogbonge country for Caribbean, Saint Kitts and Nevis, Terence Michael Drew, yesterday meet wi oga Presido Bola Tinubu for State House, Abuja, salutate di senior man wetin nor good. Based on doings afta di meet, Oga Prime minister tell tori pipo say im dey feel baba Seyi doings oh particularly im collabo as African Union member. E sha explain why im come, say […]

todayMarch 27, 2026 15

National

Oyo Gorment Promote Assembly Member, Ali And Two Chiefs, To Become Big Obas

Di Oyo State Gorment on Thursday, don approve say National Assembly member wey dey represent Oyo South, Sharafadeen Alli, plus High Chiefs Bolaji Adewoyin and Kola Babalola, go become Obas for Ibadan land. Di Commissioner for Local Gorment and Chieftaincy Matas, Ademola Ojo, konfam dis promotion inside memo wey gornment release for Ibadan. Dem promote Alli go Ekerin Olubadan, Adewoyin go Ekaarun Balogun, while Babalola go Ekarun Olubadan. Di gorment […]

todayMarch 27, 2026 11

Lagos

Tijani Fatai Begin Work As Lagos Commissioner Of Police

By: Esther Ayoola Tijani Fatai don officially take over as di 42nd Commissioner of Police for Lagos State Command. Police tuk, tuk, Abimbola Adebisi, ni Konfamate dis update for Ikeja on Thursday. Say im go replace Olohundare Jimoh wey serve as di 41st CP from February 18, 2025, to March 26, 2026, based on  new posting wey come from di police headquarters, Abuja. Fatai, wey be from Agege Local Government […]

todayMarch 27, 2026 10

Lagos

Lagos Gorment Launch Local Committees To Tackle Pikin Malnutrition

Lagos State Gorment don inaugurate local gorment and LCDA committees wey go handle food and nutrition, to tackle malnutrition for grassroots. Permanent Secretary for Ministry of Economic Planning and Budget (MEPB), Olayinka Ojo, ni tuk dis during a two-day inauguration wey hold for Ikeja. She yarn say malnutrition na serious problem for di obodo Naija. Say di gorment wan fight malnutrition by setting up dis committees wey go plan and […]

todayMarch 27, 2026 12

Lagos

Oga Govo, Sanwo-Olu Open Irele Towers As Lagos Free Trade Zone

Govo, Babajide Sanwo-Olu don open one new ogbonge free commercial building wey dem dey call Irele Towers for Lagos Free Trade Zone. For di ogbonge lunching on Thursday, baba govo say dis building go hellep boost Lagos economy, create jobs, and attract investors. Di govo thank private investors wey join hand to develop di project, explain say e go give businesses easy access to ports and other important infrastructure. Sanwo-Olu […]

todayMarch 27, 2026 14

Sports

FIFA Drop New Rules For 2026 World Cup

By: Esther Ayoola FIFA don announce new rules wey dem go use for 2026 World Cup for USA, Mexico, and Canada. Now, any player wey dem dey substitute get only 10 seconds to waka comot, or im team go play wit 10 players for one minute. Throw-ins and goal kicks get 5-second timer, and if dem delay, opposition go carry ball. Any player wey dey get medical attention must waka […]

todayMarch 27, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds