Blog masonry

Background

Lagos

Lagos Gorment Plan Move To Return Monthly Sanitation

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don announce say monthly sanitation exercise fit return to di state cause say di way di state tey dey smell nor be small. Di Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, tuk dis one afta im inspect Lagos Island on Sunday untop di dirty mata. Wahab tell tori pipo say, di gornment dey do everytin within dia power to bring back di exercise soon as pipo dey hear dey thruway dia dirty anyhow.

todayFebruary 16, 2026 4

Uncategorized

Israeli Airstrike Kpai 12 Pipo – Gaza Civil Defence Yarn

By: Rilwan Agbomeji Israeli strike don kpai at least 12 pipo since early morning on Sunday, according to Gaza Civil Defence, as military official talk say dem respond to ceasefire violation. Even though US-brokered truce wey enter second phase last month still dey on paper, fight never stop for Gaza, as Israel and Hamas dey blame each oda for breaking agreement. Rescue team talk say one airstrike hit tent wey displaced pipo dey stay for Jabalia, as anoda strike hit […]

todayFebruary 15, 2026 7

Sports

Barca Burst On Top Referee Magomago Afta 4-0 Beating

By: Rilwan Agbomeji Spanish champions Barcelona don write official complaint give Royal Spanish Football Federation over wetin dem call inconsistent refereeing. Di wahala start afta referee cancel one goal wey dem score for dia 4-0 Copa del Rey defeat against Atlético Madrid on Thursday. Barca send letter go both RFEF and di referees committee, Comité Técnico de Árbitros, demand more transparency and better standard. Dem talk say different decisions dey given for similar fouls, and say repeated referee mistakes dis […]

todayFebruary 15, 2026 9

OBODO NAIJA

3 Pipo Kpai, Plenty Odas Wunjure As Ebonyi Mining Pit Collapse

By: Rilwan Agbomeji For Enyim Agalegu community, Ikwo LGA, Ebonyi State, one mining pit don collapse, kpai at least three pipo and wunjure many odas. National Chairman of Enyim Agalegu Edukwu Opeke Union, Oboke Chukwuma Collins, talk say im receive distress call around 4 p.m. on Saturday and rush go di scene. Im join community pipo help rescue, dey remove earth wey don trap miners. Di pit na one wey First Patriots Limited dey run, wey dem before dey call […]

todayFebruary 15, 2026 6

OBODO NAIJA

Fubara Impeachment Wahala – ALDRAP Storm Rivers High Court

By: Rilwan Agbomeji Association of Legislative Drafting and Advocacy Practitioners (ALDRAP) don carry serious marras go Rivers State High Court, beg make dem sharply stop Rivers State House of Assembly from continuing di impeachment wey dem start against Govnor Sim Fubara. For di suit wey dem file on February 10 with number RHC/427/CS/2026 through lawyer S. O. Abang, dem drag plenty big names join including di Attorney-General, Speaker Martins Amaehule, some lawmakers, DSS and INEC  and tell court make nobody […]

todayFebruary 15, 2026 13

obodo oyinbo

Budget Wahala Force US Homeland Security Close Shop

By: Rilwan Agbomeji Di Department of Homeland Security don enter partial shutdown on Saturday sake of say US Congress never gree pay dem, especially over ICE operations wey dey cause gbege afta dem kill two citizens for Minneapolis raids. Thousands wey dey work for airport security, disaster relief, and oda DHS units go either carry dia kaya go house without payment or dey continue to work with no salary until money wahala settle. Democrats dey block new funding unless ICE […]

todayFebruary 14, 2026 11 18

Lagos

Kenya, Ethiopia No Gree Leave Lagos City Marathon Title

By: Rilwan Agbomeji East Africa no wan gree leave throne for Lagos City Marathon as Kenya and Ethiopia scatter everywhere for 2026 edition. Kenya Ezra Kipchumba Kerin blaze di road finish 2 hours, 11 minutes, 55 seconds take carry men title, while Ethiopia Meseret Dinke storm di women race finish 2:37:36 for Eko Atlantic. Rain fall small but race still burst 6:30am from Orca Mall, 42km warriors grind am out while crowd line Atlantic side dey shout fire for di […]

todayFebruary 14, 2026 6

Sports

I Want Make Ibrahima Konate Remain For Liverpool FC

By: Rilwan Agbomeji Liverpool FC Coachie, Arne Slot, don talk say e dey ready to do everything within im power to make Ibrahima Konate remain for Anfield. Di 26-year-old France defender dey for di last year of im contract wey e sign for 2021 when e join from RB Leipzig for £35 million deal. Konate face tough period dis season both on and off di pitch, especially afta di death of im papa, but e bounce back well when e […]

todayFebruary 14, 2026 7 1

OBODO NAIJA

Jaduga Boys Attack Tungan-Makeri, Kill 6 Pipo

By: Rilwan Agbomeji Gunmen wey dem suspect say na bandits don kill six people for Tungan-Makeri and burn police station for Konkoso, both for Borgu Local Government Area of Niger State. Di attack start around 8:00 p.m. Friday night when more than 200 armed men storm di village, dey shoot anyhow and set many houses on fire. Residents tuk say di attackers operate for hours, kill six people and force many odas to run comot from dia homes. One eyewitness […]

todayFebruary 14, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app