obodo oyinbo

135 Results / Page 8 of 15

Background

obodo oyinbo

Trump Tell Putin To Stop Firing Kyiv For Di Next 7 Days

By: Esther Ayoola Ukraine Presido, Volodymyr Zelenskyy, nor bi small happiness for am yesterday, say Donald Trump tell Russia to stop attack on Kyiv and some other towns for seven days. Zelenskyy tuk say, im support Trump and dat, e go hellep protect pipo during di cold winter. Dis pause for bombing dey come afta di leaders  tuks for United Arab Emirates, say, di next tin na to reach peace […]

todayJanuary 30, 2026 3

obodo oyinbo

Iran Ready To Strike US If Gbege Happen

By: Rilwan Agbomeji Iran foreign minister, Seyed Abbas Araghchi don yarn say Iranian army dey ready to immediately and powerfully strike back if US try attack dem. Di warning land just hours afta US Presido Donald Trump yarn again say dem fit carry military action come. Di USS Abraham Lincoln, one nuclear-powered aircraft carrier, na one of di many military tins wey US don send go Arabian Sea these past […]

todayJanuary 29, 2026 9

obodo oyinbo

Starmer Land China, Seek Beta Trade And Fresh UK–China Relationship

By: Rilwan Agbomeji UK Prime Minister Keir Starmer don waka go China for three days visit, becoming di first UK PM to go dere since 2018. E travel with about 60 British business and culture leaders, and e go meet Chinese President Xi Jinping to talk about trade and beta relationship. Inside di plane, Starmer tell reporters say e wan correct and steady China policy. Dis visit show say di […]

todayJanuary 28, 2026 9

obodo oyinbo

U.S. Top Immigration Oga, Greg Bovino To Leave Minneapolis

By: Esther Ayoola Top U.S. immigration oga, Greg Bovino and some agents go leave Minneapolis afta federal officer shoot one U.S. citizen, Alex Pretti,  and say e cause serious gbege  for  di town. President Trump don send im “border oga” Tom Homan go manage immigration work for di city as people dey watch wetin go happen next. According to report, dis kain move fit mean say, White House wan reduce […]

todayJanuary 27, 2026 8

obodo oyinbo

Australia Cancel Israeli Influencer Visa say E Tuk Bad About Islam

By: Esther Ayoola Australia don cancel visa for one Israeli influencer, Sammy Yahood, wey dey spread hate against Islam. Untop post for X, Home Affairs Minister, Tony Burke don make am clear say, make nobodi come Australia con spread hatred. Wetin di influencer writer, say, Yahood write say Islam no dey tolerate non-believers, women, pikins, and gay people, ni be di probelm. Australia Gornment like dis don dey tighten hate […]

todayJanuary 27, 2026 6

obodo oyinbo

Winter Storm Kill 11 People Across US

By: Esther Ayoola Say, one strong storm sweep across di United States kpai at least 11 people on Monday, as authorities warn residents make dem stay off road because of dangerous weather. Di storm wey dem dey call dump snow,  do wetin nor good and na so  freezing rain from Texas reach New England, spoil light and flight cancel across many states. New York City Mayor, Zohran Mamdani, tuk to […]

todayJanuary 26, 2026 7

obodo oyinbo

China, India Settle Dia Fight For Trade Tuks

By: Esther Ayoola China presido, Xi Jinping don declare dat  China and India na  good neighbours and friends wey suppose to run marras together. Oga Jinpoing dey uyan dis one, as di two of both of dem dey try  fix dia  relationship after plenty  Trump tariff  wahala wey hit dem. Xi send Republic Day greeting to Indian president Droupadi Murmu, say relationship between both countries don  dey get head small […]

todayJanuary 26, 2026 9

obodo oyinbo

UN Convoy Don Reach Kobane, Bring Food And Fuel

By: Esther Ayoola Say United Nation, UN, Office for di Coordination of Humanitarian Affairs (OCHA) Don konfamat dat,  UN convoy don reach Kobane for north Syria to hellep save lives for wia Syrian army and the Kurdish-led Syrian Democratic Forces (SDF) bin fight as ceasefire tuk continues. Di humanitarian pipo say, dem bring 24 trucks wey get fuel, bread, and ready-to-eat food for pipo wey dey suffer because of di […]

todayJanuary 26, 2026 12 7

obodo oyinbo

Trump Remove Canada From Board Of Peace Movement

By: Esther Ayoola Presido Donald Trump of di United States don withdraw Canada invitation to join im newly launched Board of Peace. Di move happen hours afta Trump formally unveil di board and days afta Canadian Prime Minister Mark Carney deliver speech for World Economic Forum, Davos 2026. For him speech, Carney praise middle powers and criticize powerful countries wey dey use economic integration as tool of coercion. According to […]

todayJanuary 23, 2026 6 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app