Sport Yarns

112 Results / Page 6 of 13

Background

Sport Yarns

NapoliĀ  Wave Bye-Bye to Conte, Allegri Fit Take Over

By : Jolayemi Olajide Napoli don confirm say coach Antonio Conte dey leave di club before im contract finish. Conte wey help Napoli win Serie A title for 2024/25 season fit soon return as Italy national team coach. Reports say Napoli don dey discuss with Massimiliano Allegri to take over di coaching job. Allegri recently lose im position after AC Milan fail qualify for next season Champions League.

todayJune 4, 2026 18

Sport Yarns

Messi collobi anoda big award, di ‘Princess of Asturias’ award for sports

By : Jolayemi Olajide Argentinian football legend, Lionel Messi, don win oda senior man award again oh, di Princess of 2026 Asturias Award for Sports based on im tear-rubber performance for football. The foundation wey dey in charge of the award give the updates on Wednesday say dem choose Messi because of im worldwide impact. The 38-year-old superstar start im career from Newell’s Old Boys youth team before im travel […]

todayJune 3, 2026 21

obodo oyinbo

Wetin be dis?! Striking teachers pull down giant football statues for Mexico, threat to scatter World Cup!

By : Jolayemi Olajide   Dey say goat wey stubborn follow lion enter bush, na im body go tell am say forest no be play ground. na serious wahala wey dey brew for Mexico City. Teachers wey dey vex don use rope pull down three giant football player statues, tear jersey commot, even set am on fire. Dem dey para say gornment no answer dem for dia labour demands as […]

todayJune 3, 2026 14

Sport Yarns

Iran Football Team wan take Risk enter 2026 World Cup Base

By : Jolayemi Olajide After all di plenty yanga,Ā  Iran football teamĀ  wan enter di 2026 world cup throughĀ  Spain dis weekend. DiĀ  team dey face serious visa delay from both Mexico, where dem wan stay for di tournament, and di United States, wia dem suppose play all dia three group matches. According to di country football chief, Mehdi Taj, dem supposeĀ  get the Mexico visa by Tuesday or Wednesday.

todayJune 2, 2026 46

Sport Yarns

Chelsea Enter Osimhen Mata As Galatasaray Put €150m Price Tag

By: Esther Ayoola Chelsea don join race to sign Super Eagles striker Victor Osimhen, as reports from Turkey say Galatasaray dey demand €150m for di Nigerian star. Speculation about Osimhen future rise afta Super Eagles coach Eric Chelle tuk say na transfer mata make di striker miss Naija friendly matches against Poland and Portugal. But Osimhen don clear di air, saying people misunderstand Chelle comment, as he insist say no […]

todayJune 2, 2026 16

Sport Yarns

Super Eagles Land Poland, Open Camp To Prepare For Friendly Matches

By : Jolayemi Olajide Super Eagles don open camp for Warsaw, Poland, as dem dey block body to face Poland and Portugal for international friendly matches. Di players land Poland early Monday morning, on top di ginger of diaĀ  win for di 2026 Unity Cup wey dem play for London. Team Media tuk, tuk, Promise Efoghe, naim sorosoke dis update,Ā  say 18 players don already show face for camp as […]

todayJune 2, 2026 18

Sport Yarns

Super Eagles Coach Eric Chelle Beg Nigerians Again As Eagles Miss World Cup

By : Jolayemi Olajide Super Eagles coachie Eric Chelle done apologize again to Nigerians as di team amaka everybody norĀ  qualify for di 2026 FIFA World Cup. The Franco-Malian coach, Wey start to dey manage the team since January 2025, say e still wan remain for the job after im current contract finish. As e remain like six months for im contract, nobody really know wetin go hapun next because […]

todayJune 2, 2026 15

Sport Yarns

Anthony Joshua declare to Show ogbonge workings for July 25

By : Jolayemi Olajide Anthony Joshua don talk say im body and mind don readyĀ  for diĀ  fight against Albanian boxer Kristian Prenga for Jeddah, Saudi Arabia on July 25. Di senior man yarn for skysport,Ā  say na boxingĀ  e wan take find imselfĀ  after im lose two friends for car askident wey hapun for Nigeria late last year. Di former heavyweight champion also tuk sayĀ  imĀ  dey build himself […]

todayJune 2, 2026 10

Sport Yarns

Chelsea Star Moises Caicedo Make book of Life Ecuador World Cup Squad

By : Jolayemi Olajide Chelsea midfielder Moises Caicedo don make di final list for Ecuador squad wey go play di 2026 FIFA World Cup inside America, Canada and Mexico. Dis na according to BBC Sport report am on Monday, June 1, 2026. Di 23-year-old ball-weaver na one of biggest names inside di team, and dis one go make am di second time wey he go dey represent im country back-to-back […]

todayJune 1, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds