Oyo State

23 Results / Page 2 of 3

Background

south west

Protesters Block Ibadan Iwo Road, Demand Release of Kidnapped Schoolchildren

By: Jolayemi Olajide Motorists and passengers wey dey use Iwo Road interchange for Ibadan suffer heavy traffic on Monday as dem protest block di busy road and scata movement for di area. Di protesters, under di Take It Back Movement, gather for di junction around 10 a.m. to demand make authorities release di Oyo schoolchildren and teachers wey kidnappers carry go. Di protest cause serious go slow as many commuters […]

todayJune 22, 2026 21

Local

Oyo Declare Tuesday Public Holiday

Oyo State government don declare Tuesday, 16th June 2026 as work-free day to mark Islamic New Year, Hijrah 1448AH. Gofnor Seyi Makinde approve di holiday as way to show respect and solidarity with Muslim community for the state. Na oga Commissioner for Information, Prince Dotun Oyelade, sorosoke di mata, say di Hijrah na important event wey mark Prophet Muhammad migration from Mecca to Medina. Gofnment still urge residents make dem […]

todayJune 16, 2026 24

south west

Gunmen Carry Former Minister Of Power Adelabu Sister And Twins For Ibadan

By: Esther Ayoola Former Minister of Power, Adebayo Adelabu, don cry out say armed men kidnap im younger sister, Olaide Busayo Adegoke John-Paul, and her 12-year-old twin boys for Ibadan. According to wetin im media aide, Femi Awogboro, talk, di attack happen early morning Wednesday as she dey carry di children go school, when gunmen block road and force dem enter motor. As Yoruba elders take tuk am, “when bush […]

todayJune 3, 2026 23

National

Wike Calm Protesters, Say Gornment Go Release Oyo Victims

By: Esther Ayoola FCT Minister, Nyesom Wike, don assure protesting teachers and civil society groups for Abuja say gornment and security agencies dey work hard to rescue di Oyo victims. Wike tuk dis one when e address di protesters for FCTA Secretariat. E also warn make people no use di insecurity mata play politics, as e express confidence say security agencies go soon secure di release of di kidnapped persons.

todayJune 3, 2026 10 17

south west

Governor Makinde Beg Government As NLC, NUT, And NANS Protest Over Oyo School Kidnap

By: Esther Ayoola Oyo State govo, Seyi Makinde, don call on all levels of gornment make dem join hand together fight security wahala and rescue di students and teachers wey bad boys kidnap for Yawota and Ahoro Esinele communities inside Oriire Local Government. Governor Makinde tuk dis one on Tuesday when im receive leaders and members of NLC, NUT, and NANS wey do peaceful protest for di state  Secretariat. Di […]

todayJune 3, 2026 12

south west

Senate Cry Out Based On Bad Boys Doings For Oyo

By: Esther Ayoola Di Senate on Tuesday don condemn di way bad boys take pakalam (kidnap) school children and dem teachers for Oyo State. Di Senate President, Godswill Akpabio, tuk say dis bad tin wey hapun na national tragedy and na attack on top everybody humanity. Akpabio cry say as di country no fit protect children and teachers, dis insecurity tin fit spoil Naija future and di education system kpata-kpata.

todayJune 3, 2026 15 5

OBODO NAIJA

Oyo Parents Reject Gornment Rice And Cash Dey Cry For Dia Pikins

By : Jolayemi Olajide Meanwhile, Angry families of dipupils and teachers wey bandits kidnap for Orire local government area for Oyo State don reject rice and money wey oyo state gorment bin give dem to cool dia temper. Di Baale of Yawota, Emmanuel Alade, clear news tatafo on Monday, how dem feel, say di parents pursue baba govo, Seyi Makinde team comot because food no be dia problem now. Di […]

todayJune 2, 2026 28

south west

Oyo Police Arrest Pastor And Woman Over Fake Bandit Killing Tori

By: Esther Ayoola Oyo State Police Command on Monday for Ibadan arrest two suspects, one pastor and one woman, over acuusate say dem deliberately spread false information say bandits kill six people for Lamini Community, Ido Local Government Area. Police tuk, tuk, DSP Olayinka Ayanlade, naim dey convasate dis mata say di arrest hapun afta thorough investigation wey confirm say di viral WhatsApp voice note and social media post no […]

todayJune 2, 2026 24

Lagos

Kidnap Mata: Oyo Teachers Down Tools, Close Public Schools

By: Esther Ayoola Teachers for Oyo State public primary and secondary schools don begin strike from June 1, 2026, as Naija Union of Teachers (NUT) order all members make dem stop work. Di union say na sake of wetin jaguda boys do to teachers and pupils for oyo state naim make dem dey protest. NUT tuk say di mata don cause fear and panic among teachers and parents across di […]

todayJune 2, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds