News-edi 1

2593 Results / Page 69 of 289

Background

Lagos

Police Gbab Four Cult Boys Inside Ojo

Lagos State Police Command don catch four men loaded with guns and bullets inside one hotel for Ajanmgbadi, Ojo area. According statement wey Police tuk, tuk, Abimbola Adebisi, release, di suspects Emmanuel Nwokolo, Ayola Israel, Ebuka Nnamdi, and Chinedu Okafor, confess say dem belong to di Aiye  cult  gang and dem dey behind di killings and violent crimes inside di community. Police sti recover two local pistols, one revolver gun, […]

todayJune 2, 2026 31

Sport Yarns

Iran Football Team wan take Risk enter 2026 World Cup Base

By : Jolayemi Olajide After all di plenty yanga,  Iran football team  wan enter di 2026 world cup through  Spain dis weekend. Di  team dey face serious visa delay from both Mexico, where dem wan stay for di tournament, and di United States, wia dem suppose play all dia three group matches. According to di country football chief, Mehdi Taj, dem suppose  get the Mexico visa by Tuesday or Wednesday.

todayJune 2, 2026 57

obodo oyinbo

Canada Suspend Immigration Documents For 3 African Countries Over Ebola Outbreak

By : Jolayemi Olajide Canada gornment don announce 90-day suspension of immigration documents for residents of Democratic Republic of Congo, Uganda and South Sudan based on di Ebola  katakata. Immigration, Refugees and Citizenship Canada (IRCC)  naim dey konfamate dis mata  and dem put am for dia  social media on Tuesday for Canada. According to IRCC, dis move  na to guide Canada against  Ebola.

todayJune 2, 2026 21

OBODO NAIJA

INEC  Begin  touchlight  Voter Database  say Mata Leak

By : Jolayemi Olajide Di Independent National Electoral Commission (INEC) on Tuesday say e don start full blood check  into allega of some jaguda boys access dia  Continuous Voter Registration (CVR) database. Dis na after information about one candidate for a political party primary election in the Federal Capital Territory (FCT) leak enter public space. INEC National Commissioner and Chairmo of Information and Voter Education Committee, Mohammed Haruna, put for […]

todayJune 2, 2026 15

Lagos

Obasa Say State Police Na Di Way For Dis Kidnap Wahala

  By : Jolayemi Olajide Teachers for Lagos don hail Speaker Mudashiru Obasa as dem protest for Lagos Assembly over di kidnap of teachers and students for Oyo State. Obasa tuk say di Assembly still dey push for State Police, saying na one major way to fight insecurity and protect schools across Nigeria. NUT Chairmo, Hassan Akintoye beg government make dem rescue all kidnapped victims and make schools no turn […]

todayJune 2, 2026 29

OBODO NAIJA

Teachers For Lagos Storm Street, Demand Freedom For Kidnapped Teachers And Students

By : Jolayemi Olajide Teachers for Lagos State sef don join di nationwide protest, for dis Oyo school children kidnap. Dem carry di wahala  go Lagos State House of Assembly for Alausa, demanding, say gorment gat raise body for di mata, everyday kidnapping kidnapping say dem don tire. Di protesting teachers, under di Nigeria Union of Teachers, trek from Ikeja Under Bridge,  raise dia  voice  dey shout abeg oh rescue […]

todayJune 2, 2026 23

OBODO NAIJA

Oyo Parents Reject Gornment Rice And Cash Dey Cry For Dia Pikins

By : Jolayemi Olajide Meanwhile, Angry families of dipupils and teachers wey bandits kidnap for Orire local government area for Oyo State don reject rice and money wey oyo state gorment bin give dem to cool dia temper. Di Baale of Yawota, Emmanuel Alade, clear news tatafo on Monday, how dem feel, say di parents pursue baba govo, Seyi Makinde team comot because food no be dia problem now. Di […]

todayJune 2, 2026 28

OBODO NAIJA

NAPPS for Oyo State comot hand say dem nor dey protest for victims of oyo kidnap

By : Jolayemi Olajide Di National Association of Proprietors of Private Schools (NAPPS) for Oyo State don comot hand flat from the protest wey dey happen for Ibadan over the security wahala inside the state. Oga of di private schools, Olukonle Fajobi naim soroshoke to tatafo, so though di mata dey pain dem and dat portest nor be di answer to di situation. He con stand strong say make everybody […]

todayJune 2, 2026 29

obodo oyinbo

Good News for DR Congo as Five Ebola Patients Recover

By : Jolayemi Olajide Five Ebola patients for DR Congo don recover and dem don discharge dem  from hospital as health workers dey continue doings to control di outbreak. Health officials say the recovery na sign  say if patients quick receive treatment, dem go survive di  Ebola. Dis latest  outbreak  don cause about 250 deaths according to tatafo, but authorities dey sti  try reduce di damage for congo.

todayJune 2, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds