News-edi 1

2593 Results / Page 70 of 289

Background

obodo oyinbo

Oil Price  Jump as Iran and US Peace Tuk Collapse

By : Jolayemi Olajide Oil price don jump wetin nor good  on Monday as Middle East peace tuk between Iran and United States jam beta rock. Crude oil price rise by about seven percent after report come out say Iran comot hand for dia tuk  with US through mediators. Dis one sef dey come after both countries exchange attack over the weekend as war mata still dey worsen.

todayJune 2, 2026 20

Sport Yarns

Super Eagles Land Poland, Open Camp To Prepare For Friendly Matches

By : Jolayemi Olajide Super Eagles don open camp for Warsaw, Poland, as dem dey block body to face Poland and Portugal for international friendly matches. Di players land Poland early Monday morning, on top di ginger of dia  win for di 2026 Unity Cup wey dem play for London. Team Media tuk, tuk, Promise Efoghe, naim sorosoke dis update,  say 18 players don already show face for camp as […]

todayJune 2, 2026 21

Sport Yarns

Super Eagles Coach Eric Chelle Beg Nigerians Again As Eagles Miss World Cup

By : Jolayemi Olajide Super Eagles coachie Eric Chelle done apologize again to Nigerians as di team amaka everybody nor  qualify for di 2026 FIFA World Cup. The Franco-Malian coach, Wey start to dey manage the team since January 2025, say e still wan remain for the job after im current contract finish. As e remain like six months for im contract, nobody really know wetin go hapun next because […]

todayJune 2, 2026 17

Sport Yarns

Anthony Joshua declare to Show ogbonge workings for July 25

By : Jolayemi Olajide Anthony Joshua don talk say im body and mind don ready  for di  fight against Albanian boxer Kristian Prenga for Jeddah, Saudi Arabia on July 25. Di senior man yarn for skysport,  say na boxing  e wan take find imself  after im lose two friends for car askident wey hapun for Nigeria late last year. Di former heavyweight champion also tuk say  im  dey build himself […]

todayJune 2, 2026 12

Lagos

Lagos Police Clear Air For One Ikorodu Video Wey Go Viral Say Na Old Gist

Lagos State Police Command don come out explain di Ikorodu viral video wey bin dey cause jogolo before say na old video. One viral video bin scata soical media dat some fulani men wan bin con kidnap pipo for Ikorodu, police arrest dem. However senior man police commissioner CP Tijani Fatai, explain di marras for Konfam radio on Monday evening dat di video na about 5 years ago and nor […]

todayJune 1, 2026 41

Health

Lagos, Hear Word! Stop Short Put, Dat Open Toilet Business AKA, Open Defecation

Di ancient elders talk say di person wey dey kahkah for road fit forget, but di person wey step on am go always remember. Today wetin we dey see na men, women and childresis dey spoil Lagos gutters and beaches with hot kahkah wey oyinbo dey call open defecation, say e don become heavy weight wey dey spoil our city face and threaten everybody health.   When people drop heavy […]

todayJune 1, 2026 22

obodo oyinbo

America, Iran Exchange Fire Again As Hormuz Tension Dey Rise

By : Jolayemi Olajide   Nor be small high tension wire for di middle east, dat  America and Iran dey test power again  around Strait of Hormuz over the weekend. Normally  di two both country agree ceasefire. According to US Central Command (wey dem call Centcom) dem do self defence  against Iranian military targets after Iran based on dem say dem say, go  shoot down one American drone for international […]

todayJune 1, 2026 18

OBODO NAIJA

Wike Burst Bubble Say Amaechi Make Mistake Join ADC Presidential Race

By : Jolayemi Olajide FCT Minister Nyesom Wike don drop micro soft word say, former Rivers State Govo, Rotimi Amaechi, dey big boy, oganaogan, con make serious mistake by contesting for 2027 presidential ticket under ADC platform. Di senior man yarn dis one for  im monthly media chat for Abuja on Monday Wike  say if to say  Amaechi  ask,  im for advice am  before joining di race, e for tell […]

todayJune 1, 2026 18 1

Sport Yarns

Chelsea Star Moises Caicedo Make book of Life Ecuador World Cup Squad

By : Jolayemi Olajide Chelsea midfielder Moises Caicedo don make di final list for Ecuador squad wey go play di 2026 FIFA World Cup inside America, Canada and Mexico. Dis na according to BBC Sport report am on Monday, June 1, 2026. Di 23-year-old ball-weaver na one of biggest names inside di team, and dis one go make am di second time wey he go dey represent im country back-to-back […]

todayJune 1, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds