News-edi 1

1355 Results / Page 8 of 151

Background

Obodo Niger

EFCC Drag Malami, Son, Wife Go Court On Top ₦8.7bn Gbege

By: Rilwan Agbomeji Former AGF Malami, im pikin Abdulaziz and one of im wives, Bashir Asabe, don face court over alleged money laundering case. EFCC charge dem with 16 counts, say dem wash ₦8.7 billion. All three people plead not guilty when dem carry dem go court on December 29, 2025. Justice Emeka Nwite order make dem remain for Kuje Correctional Centre till January 2, 2026, when court go hear […]

todayJanuary 2, 2026 16 2

Obodo Niger

Police Comot Hand For Tinted Glass Permit Marra

By: Rilwan Agbomeji Nigeria Police Force don suspend di nationwide enforcement of tinted glass permit afta court give interim order to stop am. Police bin plan to start di enforcement January 2, 2026, say na for public safety. According to Force PRO Benjamin Hundeyin, court serve police order on December 17, 2025, make dem no continue pending when court hear di main case. Police don enter appearance for court, raise […]

todayJanuary 2, 2026 14

Sports

Venus Williams Come Back Australian Open At Age 45

By: Rilwan Agbomeji Seven-time Grand Slam champion Venus Williams don get wildcard to play Australian Open at age 45, and tournament organizers talk say she go be di oldest woman wey ever play di competition. She still tuk say Australia give her many good memories and she thankful for di chance to come back to a place wey mean plenty to her tennis career. Officials confirm say Williams go break […]

todayJanuary 2, 2026 8 3

obodo oyinbo

Trump Say US Go Kwak Iran If Dem Kill Peaceful Protesters

By: Rilwan Agbomeji Unto mata for Iran, say US presido Donald Trump say America ready oh,  to robo cup for Iran gorment , if dem try kill protesters, say cost-of-living dey kill di living for Iran, as mehn dey protest am. Clash happen for different Iranian cities, and report tuk say six people don die since di protest increase. For Tehran, shop owners close dia  shops to protest high prices […]

todayJanuary 2, 2026 10

Local

Naija National Assembly Wan Release Certified Tax Bills to Clear Wahala

By Ebi Oboko Di Naija National Assembly to clear mehn doubt, say dem don dey arrange to show the general public di part of di Tax Acts wey dem say small confusion dey untop, say no wayo anywia. Director of Information, Bullah Bi-Allah, yan yesterday, say dem don direct the Clerk to release certified copies of di bills wey President Bola Tinubu don sign. Di copies go get certificate pages, […]

todayJanuary 2, 2026 7 2

Lagos

Two Kpai, Six Wunjor For Lagos Road Accident

By Ebi Oboko Unto badness wey sup on new year day, say na Two people na kpai and at least six others wunjor for different road accident wey happen for Lagos on New Year’s Day. According to Lagos state Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) oga, Adebayo Taofiq, say, one crash happen for Iyana Itire, Oshodi side, when Volkswagen commercial bus jam Toyota Sienna, wey make two people die. For […]

todayJanuary 2, 2026 8 2

National

Ondo Govo ginger mehn police to Guide Area

By  Ebi Oboko Ondo State Governor, Lucky Aiyedatiwa, dey vex serious, say jaguda boys dey worry pipo, so like dis im don send security make dem double for all communities and forest areas, after New Year attack for Ipele police station for Owo LGA. The attack happen Wednesday night as plenty people dey attend night service to welcome 2026. Di Govo say, di mata nor dey let am sleep, so […]

todayJanuary 2, 2026 8

foreign

Big Fire kpai 40+ for Swiss Ski Resort Bar

By Ebi Oboko Nor be small tin for Switzerland, say Swiss ski resort Crans-Montana, say nor nor small hell fire burn for dia, kill about 40 people and wunjor more than 100 for bar wey people dey celebrate New Year. The Fire start for Le Constellation bar around 1:30am, when plenty people dey inside. Police tuk say, wetin cause the fire, nbodi knw yet, and fire spread very fast. Swiss […]

todayJanuary 2, 2026 10

International

Israeli Soldiers Kill Pikin For Gaza Even After Ceasefire

By Ebi Oboko For Gaza, Israeli soldiers don kill one pikin wey dem dey call Youssef Ahmed al-Shandaghli for north side Jabalia an-Nazla. According to report, mehn, wimehn and childresis for Gaza dey suffer seriously because Israel nor gree make pipo con help dem for the gaza. Even with one ceasefire wey US help arrange for October, Israel still dey attack Gaza wetin nor gud, don kill over 400 Palestinians. […]

todayJanuary 2, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app