News-edi 2

1344 Results / Page 103 of 150

Background

Lagos

Iwaya Oba Dey Lament Flood As Lagos Tell Contractor Make E Finish Project On Time

The Olu of Iwaya-Yaba Kingdom, Oba Suleiman Owolabi, don beg Lagos State Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, make dem find lasting solution to di environmental wahala wey dey affect Iwaya. Oba Suleiman yan dis one during inspection of di community environment wey e do side by side with di commissioner. E remember say recent heavy rain don cause flood wey carry children go for one canal for […]

todayNovember 10, 2025 27

Lagos

Lagos Extend Permit Allowance

Lagos State Government don once again extend di closure of di popular amnesty programme wey dem start to bring many homeowners into di system make dem obtain dia planning permits and get documented. Di extension na response to property owners wey no fit benefit from di same programme last year. Dr. Oluyinka Olumide, Lagos State Commissioner for Physical Planning and Urban Development, talk say Governor Babajide Sanwo-Olu don approve di […]

todayNovember 10, 2025 28

Lagos

Lagos APC Don Tell Peter Obi To Forget 2027 After Dem Lose Polling Unit For Anambra

Lagos APC don advise Peter Obi, di 2023 Labour Party Presidential candidate, make e rethink him 2027 presidential ambition afta Anambra governorship election show say LP support dey fall for ground. Di party spokesperson, Seye Oladejo, yan say di result, especially for Obi own polling unit, show say him Obedient Movement no strong again and grassroots structure dey crumble. Oladejo talk say social media fame no fit replace solid political […]

todayNovember 10, 2025 35

National

UK Warn: No Travel Go Six Nigerian States Over Rising Insecurity

UK don issue fresh travel warning make people no waka go parts of Nigeria because insecurity dey rise, violent crime, terrorism, and kidnapping dey increase for plenty areas. Dem warn say British nationals make dem dey extra careful, review dia safety plan, and get backup plan. FCDO talk say make people no travel at all go Borno, Yobe, Adamawa, Gombe, Katsina, and Zamfara states because Boko Haram and ISWAP dey […]

todayNovember 10, 2025 67

National

Bandits Kill Elderly Woman We Dem Kidnap Because She Too Weak To Trek Kogi Forest

Suspected bandits don kidnap and k!ll one elderly woman, Mrs Elizabeth Olorunshola, for Ilafin-Isanlu community, Yagba East LGA, Kogi State. Di armed men attack di community on Saturday night, November 8, 2025, abduct di woman along Ilafin-Isanlu road and shot another person. Sources for di community yarn say di bandits shoot Mrs Olorunshola after dem see say she too weak to waka enter di forest go their hideout. Di bodies […]

todayNovember 10, 2025 41

National

Anambra Safe For Christmas, Make Una Come Home – Police Commissioner

Anambra Police Commissioner, Ikioye Orutugu, don assure say Anambra dey safe for Christmas and call on all indigenes make dem return home freely. Orutugu, wey don dey in charge of Anambra Police for nine months now as di 35th CP, talk say di state dey free and peaceful, as di recently successful governorship election show. Him yan say deliberate and proactive policing don make Anambra safe for everybody, and diaspora […]

todayNovember 10, 2025 25

Entertainment

Drugs Wahala: Regina And Nwoko Don Enter Fresh Bitter Showdown

Di marital wahala between Delta North Senator, Ned Nwoko, and Nollywood actress, Regina Daniels, don enter fresh dramatic stage as Regina admit say she don use drugs before, claim say Nwoko na him introduce am to drugs for him sexual pleasure. But Nwoko yan say na Regina brother, Sammy, wey first introduce am drugs and block all effort to help am recover. Nwoko allege say Regina family, especially Sammy and […]

todayNovember 10, 2025 57

Lagos

People Dey Fear Sickness As Garbage Dey Choke Lagos Road Dem

People for Lagos don dey fear say disease fit burst as refuse don full major roads for different areas of di state. From Iyana-Ipaja to Abule Egba, Oshodi, Iyana-Iba, Isheri-Jakande, Agege, and even Lagos Island, heaps of waste don dey scatter everywhere. Residents yan say di stench dey terrible, flies don carry everywhere, and sometimes dem no fit even open window for house. Kunle Ayeni from Igando talk say di […]

todayNovember 10, 2025 44

National

Ondo: Dem Rescue 15 Girls From Sex Trafficking Syndicate

At least 15 young girls wey dem say dem use lure enter sex trafficking under di guise of job opportunities don rescue by Ondo State Police Command. Di police also arrest three suspects wey dey linked to di syndicate. Di Command, through dia spokesperson, Olushola Ayanlade, say di girls dem wey aged between 20 and 26, dem dey recruited for Akure apartment for Alagbaka wey turn to di operational base […]

todayNovember 10, 2025 31

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds