News-edi 2

1834 Results / Page 104 of 204

Background

OBODO NAIJA

Sowore Scatta Table Say Make Nobody Trust INEC

By: Esther Ayoola Human rights activist Omoyele Sowore don untop election mata wipe INEC cord for neck, say im nor trust dem. Sowore yarn dis one for media chat wey hapun today, dat INEC nor dey free and fair but hope say dem go change for 2027. According to am, di figures wey dem dey announce for election no dey always correct, and e believe say Naija pipo naim get […]

todayMay 28, 2026 15

obodo oyinbo

13 Kpai For China Highway Crash

By: Esther Ayoola At least 13 people don die and 3 others injure after minibus jam truck for highway accident wey happen for Henan province, central China, early Thursday morning. China traffic police tok say di crash happen for G40 expressway near Nanyang city, as di bus carry 16 people instead of 9 wey am suppose carry. According to di police, di bus jam truck for di major road wey […]

todayMay 28, 2026 18

south west

Police Pour 2,500 Men Enter Ojude Oba Festival For Ogun

By: Esther Ayoola Ogun Police don spread more than 2,500 officers for Ijebu Ode and nearby areas ahead of 2026 Ojude Oba festival wey go happen Friday. Police spokesperson, DSP Oluseyi Babaseyi, yarn dis one for statement wey dem release on Thursday. According to am, di officers come from different units like Mobile Police, SWAT, Anti-Kidnapping Squad and Force Intelligence Department. Police say dem put di security arrangement to keep […]

todayMay 28, 2026 18

obodo oyinbo

Fire For Kenya Girls School Dorm Kill 16

By: Esther Ayoola Fire wey catch girls dormitory for Utumishi Girls Academy for Nakuru County, Kenya, don kill at least 16 people while 73 others dey hospital. Police source wey tuk to AFP say di fire start around 1 o’clock early Thursday morning as more than 220 girls bin dey sleep for di hostel. Emergency workers, ambulance people and rescue teams quickly reach di school to help victims and carry […]

todayMay 28, 2026 12

OBODO NAIJA

Federal High Court Go Dey Open Weekend For Election Case Filing

By: Esther Ayoola Federal High Court of Naija don order say all dia registries for every division across di kontri go dey open weekends and public holidays from 10am reach 2pm to collect only pre-election matter papers ahead of 2027 general elections. Chief Registrar of di court, Yahaya Shafa, yarn dis one for statement wey dem release on Thursday, say dem do am because di time wey law give for […]

todayMay 28, 2026 15

Lagos

Lagos Gorment Review Health Insurance Drug Scheme To Solve Medicine Shortage Wahala

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don begin review of im Drug Access Expansion Programme wey dem dey use improve how pipo under Ilera Eko and Eko Social Health Alliance dey get essential drugs. Dis one sef hapun inside one meeting dia Lagos Chamber of Commerce and Industry, Alausa, Ikeja. According to Permanent Secretary, Dr Emmanuella Zamba, say dis package start since April 2024 based on di way enrollees take […]

todayMay 28, 2026 17

Sport Yarns

FG Approve Big Rebuild For Sports Facilities Across Naija

By: Esther Ayoola Wi Federal Gornment don approve di rebuilding of sports infrastructure projects across obodo Naija. Dis na according to statement by di National Sports Commission oga, Mallam Shehu Dikko say di tin go touch di rearranging gof Abuja stadium and oda stadium across di obodo Naija. Officials say dis projects na part of efforts to boost youth development, revive sports facilities naija go dey export beta talent for […]

todayMay 28, 2026 21 1

Sport Yarns

Milan Fire Coach Allegri As Dem Fail To Enter Champions League

By: Esther Ayoola AC Milan don officially sack dem coach, Massimiliano Allegri, and dem don also change plenty things for di club management afta di team finish fifth for Serie A. Di club tuk say di way di team take collapse for di end of di season and how dem fail to qualify for Champions League na complete failure. Allegri just come back for his second time as Milan coach […]

todayMay 26, 2026 16

Sport Yarns

Evra Pick Osimhen As The Dream Striker For Manchester United

By: Esther Ayoola Former Manchester United star Patrice Evra don drop micro soft word, say Naija striker, Victor Osimhen, na di dream player wey United need to buy for next season. Osimhen, wey dey play for Galatasaray right now, once a again don dey get call from Premier League sides. Even though plenty gist don carry am go different English clubs from Merseyside reach West London, no single deal yet. […]

todayMay 26, 2026 22

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds