News-edi 2

1804 Results / Page 4 of 201

Background

OBODO NAIJA

Police Rescue Two Kidnap Victims,Kpai Three for Niger

By: Mariam Ajayi Niger State Police don rescue two pipo wey kidnappers gbab from Wako village, New Bussa, after security team clash with di gunmen for Wawa forest on September 10. Police PPRO, SP Wasiu Abiodun, say surveillance team and vigilantes intercept di kidnappers after dem demand ransom for di two victims. Di gun battle leave three suspected kidnappers dead, while di two victims escape unhurt and other gang members […]

todaySeptember 15, 2026 14

obodo oyinbo

US Supreme Court Block Trump Mail Ballot Plan

By: Mariam Ajayi US Supreme Court don block President Donald Trump plan to change how dem dey send mail-in ballots give voters across America. Di court stop di plan on Monday after election officials warn say e fit cause confusion and disenfranchise millions of voters for dis year midterm election. Two conservative justices, Samuel Alito and Clarence Thomas, oppose di decision, while di court say Trump administration no likely win […]

todaySeptember 15, 2026 6

OBODO NAIJA

NNPC Target Over 600 Trillion Cubic Feet Gas Reserve

By: Mariam Ajayi NNPCL don tok say e wan turn Naija to major gas hub for di world, using plenty gas take boost industry and export. NNPC Executive Vice President for Gas, Power and New Energy, Olalekan Ogunleye, tok dis one yesterday, Monday, September 14, 2026, for di 2026 Gas Technology and Exhibition Conference, GASTECH, for Bangkok, Thailand. Ogunleye say Nigeria get over 215 trillion cubic feet of proven gas […]

todaySeptember 15, 2026 8

Sports

Cardiff Principality Stadium Jump Enter Save Fury vs Joshua Fight

By: Mariam Ajayi Cardiff Principality Stadium jump enter center ring to save di heavy clash between Tyson Fury and Anthony Joshua after Wembley Stadium curfew almost scatter di match. Eddie Hearn and AJ don swear say di fight must happen for UK soil, but main broadcaster Netflix wan make di boxers fight by 2 AM midnight, so dat American fans fit watch di match live for dia own time zone […]

todaySeptember 15, 2026 11

obodo oyinbo

Donald Trump Blast Tech Bosses, Say Dem Mumu If Dem Fear AI

By: Mariam Ajayi US President Donald Trump don blast tech big boys, say AI go destroy di world say na big lie. Wetin hapun, na one tech oga,  Anthropic big-boy, wey dem dey call Jack Clark tell BBC  naim say make gornment  force tech companies to put mandatory kill switch button to turn off any crazy AI. Trump come jump enter e social media page dey drag  say Jack clark […]

todaySeptember 15, 2026 8

OBODO NAIJA

Northern Igbo, Women Ulama Back Tinubu 2027

By: Mariam Ajayi Bola Tinubu second-term project don gather heavy momentum as two strong forces from North jump enter motor-park to register full loyalty for e 2027 re-election bid Di Igbo Political Movement across di 19 northern states plus Abuja swear heavy oath say dem go mobilize no less than two million solid voters to drop ballots give Tinubu and all e APC boys And also Kaduna State Governor Uba […]

todaySeptember 15, 2026 8

OBODO NAIJA

Remi Tinubu Beg Country Man Save Pregnant Women, Pikins

By: Mariam Ajayi Senator Oluremi Tinubu don raise alarm as pregnant women and pikins dey die anyhow for obodo Naija, calling on leaders and billionaires to help save lives. First Lady fire dis rifle  Federal Gornment unload 215,000 pakages for  pregnant womens, dat is, 40,000 mama food-support packs, plus 40,000 sets of newborn pikin clothes to share give poor mothers for every corner of obodo Nigeria. Mama Remi clear di […]

todaySeptember 15, 2026 8

Lagos

Spark From Salon Roast Things For Ikorodu And Surulere

By: Mariam Ajayi Lagos State emergency oga, Dr Olufemi Oke, don dey cry say e no fit sleep as fire don burn traders’ money and property to dust for Ikorodu and Surulere. Di first kasala happun  for early mormor Monday for Adamo Bus Stop inside Ikorodu, as bad wire spark fire inside one hair-salon wire go touch neighboring shops, burn di shop. Before di traders fit run come save ordinary […]

todaySeptember 15, 2026 7

Politics

Obasanjo Tok Say Nigeria Help End Apartheid for South Africa

By: Kofoworola Olayinka Former Presido Olusegun Obasanjo don say South Africa for struggle to end apartheid without Nigeria strong support during di gbas gbos against white minority rule. Obasanjo tok am while speaking on Naija role in di anti-apartheid struggle, saying Naija oppose di system because dem believe say no Black person suppose dey treated like inferior human being. E say  make Naija join hands with other African leaders to […]

todaySeptember 14, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds