Blog masonry

Background

National

Hallelujah Challenge Day 15 Don Pass One Million Views Online

Di 2025 edition of Hallelujah Challenge, wey be global online praise and worship led by popular Nigerian gospel singer Nathaniel Bassey, don break record again as e pass 1.2 million views across social media during di midnight session on Wednesday. Di News Agency of Nigeria (NAN) report say people from all over di world join for YouTube, Facebook, Instagram and TikTok to worship together on day 15 of di October session. Wetin start as small Instagram Live session in 2017 […]

todayOctober 22, 2025 6

Sports

Arsenal Na Kings of Spain, Gunners Smash Record After Dem Wipe Atletico

Arsenal raise plenty eye for Europe after dem hammer Atletico Madrid 4-0 for Emirates Stadium on Tuesday night. But no be only one-off win for Mikel Arteta side, na historic run dem dey make as dem don win seven straight games against Spanish teams for Champions League, something no other team don ever do before. Dem beat Atletico after dem already knack Athletic Club, Real Madrid (home and away), Girona, and Sevilla for past matches. Di last time Arsenal fail […]

todayOctober 22, 2025 8

National

NCDC Report 172 People Don Die from Lassa Fever

Di Nigeria Centre for Disease Control and Prevention (NCDC) don talk say 172 people don die from Lassa fever for 21 states, with Case Fatality Rate (CFR) wey don rise reach 18.6%, pass di 17% wey dem record for same time in 2024. For dia Lassa Fever Situation Report for Week 40 (Sept. 29 – Oct. 5), NCDC talk say dem don confirm 924 cases out of 8,041 suspected ones from 106 Local Government Areas. Ondo, Bauchi, Edo, Taraba and […]

todayOctober 22, 2025 6

National

UK Link Nigeria, Others to Poison Alcohol Drinks

Di UK Foreign Office don add Nigeria and seven other countries join warning list wey dey alert travellers about di danger of methanol poisoning from fake or contaminated alcohol drinks. Di other countries wey join Nigeria for di list na Ecuador, Japan, Mexico, Peru, Russia, Uganda and Kenya. Dis update enter dia travel advice after wahala wey involve some Britons wey don jam problem for those countries. Before now, di warning bin cover places like Thailand, Laos, Vietnam, Cambodia, Indonesia, […]

todayOctober 22, 2025 7

Lagos

Hit-and-Run Driver Kill Lagos Director Just Days to Retirement

Na serious tragedy strike as one director for Lagos State Government, Serifat Talabi, die just four days before she retire from service and celebrate her 60th birthday. Di woman, wey be Director of Procurement for Lagos State Residents Registration Agency (LASSRA), bin dey cross Lagos-Ibadan Expressway near Redemption Camp on Saturday when one hit-and-run driver jam am run. Dem rush am go hospital but she later die. Sources talk say she suppose retire on Monday, October 13, but di send-forth […]

todayOctober 22, 2025 6

Lagos

Azubuike Beg Lagos Gov, King – Say Sorry, Drop ‘Obi of Lagos’ Title

Di self-claim 'Obi of Lagos', Chibuike Azubuike, wey police arrest for Lagos in September over fraud matter, don finally apologise to Lagos State Government and di Oba of Lagos. Azubuike bin plan do New Yam Festival for Amuwo Odofin, Lagos, for September, but people vex say e dey try bring Igbo culture come Yoruba land. Di wahala make am face serious backlash. Now, for public notice wey appear for national newspaper, Azubuike don beg well-well and promise say him go […]

todayOctober 22, 2025 3

Lagos

JUST IN: Fire Don Burn Shops for Alaba Market

One serious fire wey happen Tuesday evening don scatter parts of di popular Alaba International Market for Lagos, as e burn plenti shops and cause heavy panic among di traders. One TikTok live video by one user wey dem dey call KB Clothings show as thick smoke dey rise from different parts of di market, while traders and people wey gather dey shout and cry, no fit do anything. Many traders wey see say their goods don dey burn begin […]

todayOctober 22, 2025 9

Local

Tomato Price Don High Because Supply And Storage Dey Yawa

Tomato traders for Lagos don raise alarm say di wahala wey dem dey face don make tomato price waka go up. According to reports, many of dem blame di hike on poor storage, police wahala for road, insecurity for North, and transport stress. One trader talk say him stop to dey import tomatoes from Ghana because checkpoint full everywhere  “every checkpoint na money,” he talk. Mr Saidu Idrisu wey dey sell for FESTAC talk say dem no get better storage, […]

todayOctober 21, 2025 16

Lagos

You Fit Comot If You No Follow Estate Rules – LASG Yarn

Lagos State Government don issue strong warning say e go fit revoke home allocations for allottees wey no follow estate rules for government-owned housing estates for state. Di warning come from Housing Commissioner, Moruf Akinderu-Fatai, wey talk through Permanent Secretary, Engr. Abdulhafiz Toriola, during monthly stakeholders meeting for Sir Michael Otedola Housing Estate, Epe. Dem talk say allottees wey no pay facility maintenance fees and insurance premiums or wey dey do unauthorised structural changes for dia houses go face sanctions […]

todayOctober 21, 2025 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app