News-edi 1

1355 Results / Page 5 of 151

Background

Lagos

iPhone Scam: Lagos Police Catch Woman for 500 Million Scam

By Ebi Oboko Lagos police command share update on wetin dey play for tech business for di obodo naija, say dem don arrest one 35-year-old woman, Modupeola Bamisade, for allegedly scamming over 100 people of more than N500 million. The Lagos State Police Command say she dey sell iPhones, iPads and other Apple products online, dey offer 50 per cent discount to attract customers. According to Police source on Wednesday, […]

todayJanuary 8, 2026 2

Lagos

Top African Artistes Enter Area For Lagos As AFRIMA 2026 Take Over Naija

By Ebi Oboko Unto joliment marras for Lagos, say Sixteen top African artistes don land di obodo Naija as Lagos State dey host the 9th edition of All Africa Music Awards, AFRIMA, say di mata sef go run for one week. Dis event start from Wednesday January 7 and go end on Sunday January 11, with big Owambe pari on Friday for Ikeja and the main awards night for Victoria […]

todayJanuary 8, 2026 4 1

National

Regina Daniels Do Drug Test

By: Rilwan Agbomeji Nollywood actress Regina Daniels don break silence on recent controversies wey dey surround her life by undergoing drug test. She reveal dis one on her Instagram page on Wednesday, talk say e follow months of personal struggles and public scrutiny. According to Daniels, di past few months don heavy, nearly overwhelm her, and e make her rethink plenty things for her life. She explain say di decision […]

todayJanuary 7, 2026 15

National

Palace Aide Stop Woman Shake Olu of Warri Hand

By: Rilwan Agbomeji One viral video don show how an aide to di Olu of Warri, Ogiame Atuwatse III, gently stop one woman wey wan shake di monarch hand for palace lounge. Di 47-second clip wey start trend on Tuesday show di Olu dey waka with im entourage wey dey wear traditional red and white Itsekiri attire. According to palace custom, any subject wey wan greet di Olu no fit […]

todayJanuary 7, 2026 4

Sports

NFF Calm Fear Say Fight Nor Dey Eagles AFCON Camp

By Ebi Oboko Nigeria Football Federation don play down tori say wahala dey for Super Eagles camp for 2025 AFCON for Morocco after small clash happen between Victor Osimhen and Ademola Lookman for pitch. The incident happen during Nigeria 4–0 win against Mozambique for Fez Stadium, as Osimhen score two goals while Lookman and Akor Adams add one goal each. Despite the big win, people notice when Osimhen and Lookman […]

todayJanuary 7, 2026 4 1

foreign

Saudi Coalition Fire Bomb for Yemen South

By Ebi Oboko Saudi Arabia-led coalition day never break, early mor mor confamate say, dem don fire bomb scarra Dhale, Yemen, on Wednesday. Say Southern Transitional Council (STC) leader Aidarous al-Zubaidi even jump comot plane wey im suppose use fly, use leg pick race for di mata, and dat up till now nobody know wia im enter. Coalition add say e don gather plenty soldiers, tanks, gun, and munitions for […]

todayJanuary 7, 2026 4 1

National

Jonathan Put Pledge to Join PDP Fight for 2027 Election

By Ebi Oboko Wi Former Presido, Goodluck Jonathan don knack hand for chest say e go dey more active for Peoples Democratic Party matter for 2027 election. Na PDP National Chairman, Tanimu Turaki (SAN) share dis update after private meeting with di  former presido on tuesday. Turaki waka go Jonathan Maitama office with all National Working Committee, some former governors, party founding fathers, and few selected state chairmo say dem […]

todayJanuary 7, 2026 9 5

Lagos

Governor Sanwo-Olu Ginger Lagos Storytellers to Do More

By Ebi Oboko Oga Govo of Lagos, Babajide Sanwo-Olu, omo enter area, don ginger aproko pipo wey be say dia work na to tell story about Lagos, say, make dem no give up, say make dem continue and to also joinbodi with goment to grow the creative economy. The govo dey tuk Dis one on Tuesday for Lens for Good 2026 Storytellers’ Conference wey carry di theme “Stories dat Move […]

todayJanuary 7, 2026 4 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app